I dey pray sey as en glory big rish, E go make una strong well-well with pawa thru en Spirit wey bi di really pesin inside una. So dat Christ go dey inside una heart thru faith and wen una don strong well-well inside God love, una go fit join all God pipol undastand how God love wide, long, high and deep rish. Den una go really know di love wey Christ get, wey big pass evritin wey una go fit undastand and evritin inside God, go full una life.