Make una nor dey drink strong drink, bikos e go distroy una. But make una allow God Spirit fill una mind. Make una dey tok to unasef with psalms, hymns and spiritual songs. For inside una heart, make una dey praiz God with hymns and psalms. With awa Oga God Jesus Christ name, make una dey tank God awa papa for each oda.