Judges 5
5
Deborah Song
1For dat day, Deborah and Barak, Abinoam pikin, sing dis song:
2“Make una praiz God!
Israel leaders agri to go fight
and di pipol happy follow dem.
3Una wey bi king, make una listin!
Una wey bi rulers, make una hear mi!
Bikos I go sing and play music give God,
di Oga for Israel.
4My God, wen Yu komot from Seir go Edom,
di eart shake and rain start to fall from di sky;
5di Oga wey bi Sinai
and Israel God, mountins skata for yor present.
6For di time wey Shamgar, Anat pikin
and Jael dey rule,
pipol nor dey gri pass di main road
and dem dey hide travel.
7Na only few pipol remain for Israel village,
until Deborah kom stand
as Israel pipol mama.
8Den war start for di town
bikos Israel pipol bigin serve oda gods.
But e get any man for Israel among di 40,000 men
wey karry shield or spear go fight?
9I like doz leaders for Israel
and doz wey gri to fight war.
Make wi praiz God!
10Una wey dey ride fine donkey;
wey dey use fine blanket for una horse
and doz wey dey take leg waka,
make una tok about am. 11Make una listin,
doz wey dey near di well dey sing,
bikos God and Israel pipol don win!
Den God pipol go mash
kom from dia towns.
12Deborah, make yu wake-up!
Deborah, I sey make yu wake-up!
Make yu wake-up kon sing song!
Barak wey bi Abinoam pikin,
make yu stand up go free doz wey dey prison.
13Den doz wey remain kom down from Tabor go meet dia leaders. God pipol dey ready to fight.
14Dem from Efraim go di valley,
di land wey bi Amalek pipol own before
and dem follow Benjamin tribe with en men.
Di kommanders kom from Makir
and di ofisas kom from Zebulun.
15Di prince dem for Issakar dey with Deborah
and Barak.
Dem follow Barak go di valley.
But Reuben tribe divide,
bikos dem nor gri kom.
16Why una sidan for house with di sheep?
Na to listin to di shepad wen dem koll dia animals?
‘Yes!’ Reuben tribe divide
and dem nor gri kom.
17Gilead pipol dey for Jordan River east,
while Dan pipol dey near di sheep.
Asher pipol nor gri komot from di wotaside,
dem dey stay near di river.
18But Zebulun and Naftali pipol risk dia life
kon go fight war.
19Kanaan kings kom fight
for Taanak near Megiddo wota,
but dem nor take any silva komot der.
20From di sky, di stars dey move
and fight against Sisera.
21Kishon River karry dem go.
So I go mash face dem with full force!
22Di horse dem dey shake di groun,
bikos dem dey mash am pass with force.
23God angel sey, ‘Make una curse Meroz pipol.
Make curse follow dem,
bikos dem nor gri help God pipol;
dem nor kom fight for dem.’
24Jael wey en husband na Heba
wey kom from Kanaan,
na-im dey bless pass among evry woman.
Na Jael God bless pass all di wimen
wey dey stay tent.
25Sisera ask am for wota, but e gi-am milk.
E use fine bowl take bring di milk for am.
26Den e use en left hand take hold di nail
kon hammer Sisera thru en head with en rite hand.
27Sisera fall kon knee down for di woman front.
Na di woman leg e fall near and na der e for die
28Sisera mama look outside from window,
bikos e dey wait for Sisera make e kom,
den e kon sey,
‘Why en shariot nor kwik kom?
Why wi nor dey hear en shariot nois?’
29Di wise wimen dem ansa am,
but di woman still dey tell ensef sey,
30‘May bi dem dey divide di tins wey dem seize;
dat is, one girl or two for evry man.
Sisera dey gada fine klot;
klot wey dem design well.
Yes! Fine-fine robe wey dem design for di two side,
dey join wetin dem seize.’
31My God, make all yor enemies die like Sisera!
But make doz wey love Yu, shine like sun!”
So peace kon dey for di land for forty years.
ទើបបានជ្រើសរើសហើយ៖
Judges 5: pcm
គំនូសចំណាំ
ចែករំលែក
ចម្លង

ចង់ឱ្យគំនូសពណ៌ដែលបានរក្សាទុករបស់អ្នក មាននៅលើគ្រប់ឧបករណ៍ទាំងអស់មែនទេ? ចុះឈ្មោះប្រើ ឬចុះឈ្មោះចូល
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee