Judges 16
16
Samson Go Gaza
1One day, Samson go Gaza wey bi Filistia pipol town and e stay der thru-out with one ashawo. 2Gaza pipol kon know sey, Samson dey for der, so dem gada for di town gate dey wait for am till day break. Dem sidan kwayet dey tok for dia mind sey, “If morning rish, wi go kill-am.”
3But Samson stay bed go rish mid-nite, den e get up go di town gate pul am with di two pila kon karry am for en shoulder go Hebron hill.
Samson and Delilah
4Afta sometaim, Samson kon love one woman wey en name na Delilah, wey dey stay for Sorek Valley. 5All di five rulers for Filistia go meet Delilah kon sey, “Make yu deceive Samson, so dat e go tell yu wetin make am dey strong and how dem fit take stop am. Den yu go find way take tie am with rope well-well. Afta evritin, each of us go give yu 1,000 one hundred silva.”
6So Delilah go meet Samson kon tell, “Abeg, make yu tell mi, ‘Wetin make yu dey strong like dis and wetin pesin go fit do, if e won tie yu?’ ”
7Den Samson ansa, “If dem tie mi with seven new strong rope wey nor dry, I go dey weak well-well.”
8So Filistia rulers bring seven new strong rope kon give Delilah, den e use am take tie Samson. 9By dat time, Delilah hide some men for di oda room, den e shaut, “Samson! Filistia pipol don kom katch yu o-o!” But Samson kut di rope, just as tread dey kut if yu take fire tosh am. So dem nor still know di sekret wey make am get pawa.
10Leta, Delilah kon tell Samson, “Si, yu dey lie for mi kon make mi bi like fool! Abeg, make yu tell mi di trut, na how dem fit take tie yu?”
11Samson ansa am, “If dem tie mi with new rope wey dem neva use before, I go weak well-well.”
12So Delilah take new rope kon tie am. Di men dey di oda room dey wait, so e kon shaut, “Samson! Filistia pipol don kom katch yu!” But e kut di rope komot for en hand like sey na tread.
13Den Delilah tell am, “Yu still dey lie and fool mi! So naw, make yu tell mi how pesin fit take tie yu.”
Den Samson ansa am, “If yu plait my hair into seven part kon use peg take make am tit, I go dey weak well-well.” So wen Samson dey sleep, Delilah kon plait di hair into seven part. 14Den e tit am with di peg.
E kon shaut again, “Samson! Filistia pipol don kon katch yu o-o!” So Samson wake-up, remove di peg, den luz en hair.
15Den Delilah vex kon tell am, “Why yu dey tell mi sey, ‘I love yu’ and yu nor fit trust mi kon tell mi yor sekret? Yu don fool mi three times naw and yu neva still tell mi wetin make yu dey strong!” 16Delilah kontinue to dey tok and komplain until Samson kon taya for en wahala, 17so e tell am di trut at last.
E sey, “Dem neva kut my hair wons, bikos wen dem born mi, dem dedikate mi give God as Nazirite. So if yu kut my hair, my pawa go leave mi and I go kon dey weak just like anybody.”
18Delilah just know sey Samson don tell am di trut, so e send message go give Filistia rulers sey, “Make una kom back just dis last time, bikos e don tell mi di trut.” So dem bring di money follow body kom. 19Delilah deceive Samson sleep for en lap, den koll one man make e kut di seven hair komot. Den e put am for groun small-small, bikos en pawa don leave am.
20Den e shaut, “Samson! Filistia pipol don kon katch yu!”
E wake-up kon tell ensef, “I go do as I dey do before, I go shake mysef and dey free.” E nor know sey Oga God don leave am.
21So Filistia pipol katch am kon blind en eye, den dem tie am with bronze shain; take am go Gaza kon force am make e dey grind korn for prison. 22But e nor too tey, before en hair kon dey grow kom again.
Samson Viktory
23Filistia rulers dey do party, offa sakrifice and dey praiz dia god wey bi Dagon kon dey sey, “Awa god don give us viktory ova Samson wey bi awa enemy!”
24Wen di pipol si am, dem praiz dia god sey,
“Awa god don diliver awa enemy give us!
Di pesin wey kill many of awa pipol
don dey under awa pawa naw!”
25Many of dem don drink by naw, so dem sey, “Make una bring Samson kom out make e kon make us laf!” So dem bring am kom out from di prison and e stand between di two pila wey dey support di building. Dem kon dey play with am, so dat e go make dem laf.
26Den Samson tell di boy wey hold en hand sey, “Make yu put my two hand for di pila wey hold di temple, bikos I won rest my body.” 27By dis time, di temple don already full with pipol. All di five Filistia rulers dey der and about 3,000 men and wimen dey der dey wosh Samson as e dey make dem laf. 28Den Samson pray give God sey, “Oga God wey get pawa, remember mi again. My God! Abeg make Yu give mi pawa one more time. Make I pay Filistia pipol back for my eye wey dem blind.” 29Samson put en two hand for di pila wey hold di temple kon push am, 30den e pray sey, “My God, make Yu allow mi die with Filistia pipol wey bi my enemies.” Den di temple fall skata for di five rulers and di pipol head. Di pipol wey Samson kill wen e dey die, many pass di ones wey e kill wen e dey alive.
31Afta, en brodas and family kon karry en dead body. Dem take am go beri between Zorah and Eshtaol, where dem beri en papa Manoah put. Samson lead Israel pipol for twenty years.
ទើបបានជ្រើសរើសហើយ៖
Judges 16: pcm
គំនូសចំណាំ
ចែករំលែក
ចម្លង

ចង់ឱ្យគំនូសពណ៌ដែលបានរក្សាទុករបស់អ្នក មាននៅលើគ្រប់ឧបករណ៍ទាំងអស់មែនទេ? ចុះឈ្មោះប្រើ ឬចុះឈ្មោះចូល
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee