Judges 11
11
Jeftah Rule Israel
1Jeftah na one strong man for Jabesh-Gilead. En mama na ashawo and na en papa bi Gilead. 2Gilead wife for house still born oda sons for am and wen di oda sons don big, dem kon tell Jeftah, “Make yu nor tink sey yu go get any of awa papa propaty, bikos na ashawo born yu. So make yu komot awa house.” 3So Jeftah komot from di house kon go stay for Tob town. Na for der e for make sturbon friends kon dey follow dem waka.
4E nor too tey, before Ammon pipol kom fight Israel pipol. 5Wen di fight start, Gilead leaders kon go tell Jeftah for Tob town 6sey, “Make yu kom lead us go fight Ammon pipol.”
7But Jeftah ansa, “Nor bi bikos una hate mi well-well, naim make una force mi komot from my papa house. Why una kom meet mi naw wen una dey trobol?”
8Dem ansa, “Wi kom meet yu, bikos wi wont make yu lead all of us for Gilead go fight Ammon pipol.”
9Den Jeftah tell dem, “If I follow una go fight Ammon pipol and God give mi viktory, I go bi una ruler?”
10Dem ansa, “Yes! Wi agri and na God bi awa witness.” 11So, Jeftah follow Gilead leaders go back and di pipol kon make am dia leader and ruler. Jeftah tell dem wetin e wont wen dem dey God present for Mizpa.
Jeftah And Ammon King
12Afta, Jeftah send messenjas go meet Ammon king kon ask am, “Wetin make yu won attack awa land?”
13Ammon king ansa, “Na bikos Israel pipol take my land, wen dem dey kom out from Egypt. Dem take my land wey start from Arnon River for sout go rish Jabbok River for nort and Jordan River for west. So make una give mi back, so dat peace go dey.”
14Jeftah kon send messenjas go back go meet Ammon king 15sey,
“Israel pipol nor take Moab and Ammon pipol land. 16Wen dem komot from Egypt, dem travel pass di desert from di Red Sea till dem rish Kadesh. 17Israel pipol send messenjas go meet Edom king sey, ‘Abeg make yu allow us pass yor land.’ But Edom king nor gri. Dem still tell Moab king di same tin, but e nor gri too. Den Israel pipol kon stay for Kadesh.
18Israel pipol pass thru di desert and dem nor tosh Edom or Moab pipol with dia land. Dem travel go east for Moab land kon go kamp for di oda side for Arnon River, but dem nor cross Arnon, bikos Arnon divide Moab kountry.
19Israel pipol send messenjas go meet King Sihon for Amor wey dey rule from Heshbon sey, ‘Abeg make yu allow us pass yor land go awa land.’ 20But King Sihon nor gri, instead, e gada all en sojas, go kamp for Jahza kon attack dem.
21But di Oga wey bi Israel pipol God, make dem win King Sihon and en sojas. So dem kon take di land wey bi Amor pipol own. 22Dem take Amor land, from Arnon River for sout go rish Jabbok River for nort and from di desert wey dey for east go rish Jordan River for west.
23Since di Oga wey bi Israel pipol God don drive Amor pipol komot bikos of en pipol, yu tink sey yu go fit just kom take am from dem? 24Yu fit take anytin wey Kemosh yor god give yu, but wi go take all di land wey di Oga awa God give us. 25Yu tink sey yu betta pass Balak, Zippor pikin wey bi Moab king? E try to shalenge Israel pipol, abi e nor do am? E nor ever fit fight us. 26For three hundred years naw, Israel pipol dey stay for Heshbon and di towns wey dey near am; Aroer and di towns wey dey near am and di oda town wey dey Arnon! Why yu nor kom klaim di land, dat time? 27I neva do yu any bad tin, but naw, yu dey do mi bad as yu kom attack mi. Make God wey dey judge, judge today between Israel and Ammon pipol!”
28But Ammon king, nor listin to Jeftah message.
29Dat time, God Spirit dey with Jeftah and e kon go Gilead and Manasseh town. E lead en sojas from Mizpa wey dey Jabesh-Gilead, go fight Ammon pipol. 30Jeftah make vow give God sey, “If Yu make mi win Ammon pipol, 31anytin wey go first kom out from my house kom welkom mi, I go sakrifice am as burn ofrin give Yu.”
32So, Jeftah lead en sojas go fight Ammon pipol and God gi-am viktory. 33E kill Ammon pipol kon distroy about twenty towns, from Aroer go rish one aria wey near Minnit till e distroy rish Abel-Keramin. Na like dis Israel pipol take win Ammon pipol.
34Wen Jeftah rish en house for Mizpa, en only pikin wey e get for en life, run kom out kon meet am, dey dance and play tamborin with happiness. 35Wen e si am, e vex kon tear en klot. E kry kon shaut, “Oh my dota! Yu don distroy mi! Yu don kause wahala for mi! I don make vow give God and I nor go fit take am back.”
36Naim di girl sey, “Papa, if yu make vow give God, den yu must do wetin yu vow, bikos na God give yu viktory ova yor enemies, Ammon pipol. 37But first allow mi go do dis one tin: Allow mi go on-top di hill go roll and kry with my friends for two mont first, bikos I go die as virgin.”
38Jeftah tell am, “Yu fit go.” So Jeftah allow am go for two monts. Di pikin and en friends kon go di hill for two monts dey kry, bikos e nor go ever born shidren. 39Wen e rish house, di papa do di vow wey e make give God kon kill di girl as virgin.
So dis tin kon bi tradishon for all di yong girls wey dey for Israel. 40So Israel yong wimen, dey komot for four days evry year go mourn, bikos of wetin happen to Jeftah pikin.
ទើបបានជ្រើសរើសហើយ៖
Judges 11: pcm
គំនូសចំណាំ
ចែករំលែក
ចម្លង

ចង់ឱ្យគំនូសពណ៌ដែលបានរក្សាទុករបស់អ្នក មាននៅលើគ្រប់ឧបករណ៍ទាំងអស់មែនទេ? ចុះឈ្មោះប្រើ ឬចុះឈ្មោះចូល
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: