Judges 1
1
Judah And Simeon Take Di Land
1Afta Joshua die, Israel pipol kon ask God, “Na wish tribe go first go attack Kanaan pipol?”
2God ansa, “Na Judah tribe, bikos I don give dem viktory ova di land.”
3Den Judah men tell dia relashon from Simeon tribe sey, “Make una join us go fight Kanaan pipol wey dey di aria wey God give us. Den wi go follow una go fight and win una own aria too.” So Simeon men follow Judah pipol.
4Wen Judah men attack, God make dem win Kanaan and Periz pipol and dem kill 10,000 men wey dey fight war for Bezek town. 5As dem dey Bezek, dem meet King Adoni-Bezek kon fight am. Dem win Kanaan and Periz pipol. 6King Adoni-Bezek kon dey run, but Israel pipol porshu and katch am, den dem kut en big finger from en hand and en big toe for en leg komot.
7So Adoni-Bezek sey, “I don kut seventy kings hand and leg komot wons and I make dem chop food from under my tabol. But naw, God don pay mi back for wetin I do to dem.” So, dem karry am go Jerusalem and e die for der.
8Den Judah men attack and seize Jerusalem; dem kill all di pipol kon burn di town rish groun.
9Afta, dem go fight Kanaan pipol wey dey stay for di hill kountry; Negev and for di hill bottom wey dey for di west side. 10Dem mash against Kanaan pipol for Hebron (wey dem dey koll Kiriat-Arba before), dem stay der kon fight and win Sheshai, Ahiman and Talmai pipol.
11From der, dem go fight doz wey dey Debir town (wey dem dey koll Kiriat-Sefer before). 12Den Kaleb sey, “I go give my dota Aksah as wife to anybody wey go attack and seize Kiriat-Sefer.” 13Kenaz wey bi Kaleb yonga broda, na-im pikin Otniel attack and seize Kiriat-Sefer. So Kaleb pikin, Aksah kon bi Otniel wife.
14Di day wen Otniel dey marry Aksah, e kon tell di girl sey make e ask en papa for land. So as di girl kom down from en donkey, Kaleb kon ask am, “Na wetin yu wont?”
15E ansa, “Abeg make yu give mi anoda gift. Yu don already give mi land for Negev, but naw, I wont make yu give mi place where wota dey.” Den Kaleb kon gi-am di spring for up-and-down.
16Moses fada-in-law shidren-shidren, wey bi Ken pipol, follow Judah pipol komot from Jeriko, di palm trees town, till dem rish di wildaness for Judah. Dem go stay with doz wey dey der, near Arad town for Negev.
17Afta, Judah pipol join Simeon pipol go fight Kanaan pipol for Zefat and dem skata di town finish. Leta, dem kon koll di town, Hormah. 18Dem still attack Gaza, Ashkelon and Ekron town and di oda towns wey dey near der.
19God dey with Judah pipol, so dem take di hill kountry. But dem nor fit drive di pipol wey dey di koast aria komot, bikos di pipol shariot, bi like iron. 20So dem give Kaleb, Hebron town just as Moses promise. So Kaleb porshu Anak generashon komot der. 21Benjamin tribe nor fit porshu Jebus pipol komot Jerusalem finish, so till today, Jebus pipol still dey stay for Jerusalem with Benjamin pipol.
22Josef shidren-shidren, attack Bethel town and God help dem. 23Dem send men go spy Bethel (wey dem dey koll Luz before). 24Dem meet one man dey kom out from di town kon ask am, “Make yu show us how to enter dis town and wi nor go kill yu.” 25So e show dem and dem kill evribody wey dey di town, escept di man and en family. 26Leta, di man komot from der kon go Hit pipol land and e build en own town wey e koll, Luz for der. Naim dem still dey koll am till today.
27Manasseh pipol nor fit drive di pipol for Bet-Shean, Taanak, Dor, Ibleam, Megiddo and doz wey dey near der. So doz pipol still dey stay der. 28Israel pipol kon get pawa well-well and dem force and turn Kanaan pipol to dia slave, but dem nor drive all of dem komot from di land. 29Efraim tribe nor fit drive Kanaan pipol wey dey Geza, so Kanaan pipol still dey stay der with dem. 30Zebulun tribe nor fit drive di pipol wey dey Kitron and Nahalol, so Kanaan pipol still dey stay among dem. But dem force and turn Kanaan pipol to dia slave. 31Asher tribe nor fit drive di pipol wey dey Akko, Sidon, Ahlab, Akzib, Helbah, Afek and Rehob, komot. 32Instead, Asher pipol dey stay and kontrol Kanaan pipol wey dey di land, bikos dem nor fit porshu dem komot. 33Na so too, Naftali tribe nor fit drive Bet-Shemesh and Bet-Anat pipol komot, instead, dem dey stay and kontrol Kanaan pipol wey dey di land. Dem force di pipol to work for dem as dia slave. 34Amor pipol force Dan tribe go stay for di kountries wey dey di hill and dem nor let dem kom down again. 35Amor pipol still dey stay for Mount Heres, Aijalon and Shaalbim, but wen Josef shidren-shidren don strong well-well, dem kon force Amor pipol to work as dia slave. 36Amor pipol borda start from Skorpion Pass go rish Sela and e still kontinue from der go.
ទើបបានជ្រើសរើសហើយ៖
Judges 1: pcm
គំនូសចំណាំ
ចម្លង
ប្រៀបធៀប
ចែករំលែក
ចង់ឱ្យគំនូសពណ៌ដែលបានរក្សាទុករបស់អ្នក មាននៅលើគ្រប់ឧបករណ៍ទាំងអស់មែនទេ? ចុះឈ្មោះប្រើ ឬចុះឈ្មោះចូល
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee