1 Samuel 19:1-2
1 Samuel 19:1-2 PCM
Den Saul tell en pikin Jonatan and all en savants sey make dem kill David. But Saul pikin Jonatan like David well-well. So e kon tell David, “My papa dey try to kill yu. So make yu take kare as yu dey waka for morning and find somewhere go hide and make yu stay der alone.

