Gideon ansa, “My Oga! If God really dey with us, wetin make all dis tins dey happen to us? And where all di mirakle wey awa grand-grand papa dem tell us? Bikos dem sey, ‘Na God take us komot from Egypt!’ But naw, God don forget us kon allow Midian pipol dey rule us.”