YouVersion Logo
Search Icon

Psalms 4

4
Prayer For Help For Evening
For Di Kwayamasta: David Song
1My God, make Yu ansa mi wen I koll Yu.
Na only Yu go fit diliver and free mi
from wiked pipol and all my trobol.
Make Yu sorry for mi kon hear my prayers.
2Na how long pipol go take dey tok bad about mi?
How long una go dey tok wetin I nor do?
How long una go kontinue to dey lie for my head?
3Make una know sey,
God dey keep doz wey dey fear am for ensef
and E go ansa wen wi koll am.
4So make yu fear God and nor sin.
Make yu tink about am for nite kon turn from yor sins.
5Make yu offa sakrifice with di rite spirit give God
kon trust am.
6Many pipol dey sey,
“Who go fit show us wetin dey good?”
So my God, make Yu smile for us.
7Yu don give mi more joy pass doz wey get many food
and wine to drink.
8I dey sleep with peace,
bikos na only Yu wey bi my God,
dey save mi.

Currently Selected:

Psalms 4: pcm

Highlight

Share

Compare

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in