Psalms 20
20
Prayer To Win
For Di Kwayamasta: David Song
1Wen yu dey for trobol, make God ansa yor kry for help.
Make Jakob God name, save yu from all wahala.
2Make E kom help yu from en temple,
den give yu pawa from Jerusalem.
3Make E remember all di gifts wey yu gi-am,
den favor yu, bikos of yor ofrins.
4Make E do evritin wey yu wont
and make yu prosper for evritin wey yu dey do.
5Make wi shaut for joy wen wi hear viktory sound
kon raiz awa banner wey dey show awa God name.
Make God ansa all awa prayers.
6Naw, I know sey God dey save di king wey E anoint.
E ansa di king from en heaven wey dey holy
kon save am with en great pawa.
7Some nashon dey make mout and trust dia shariot and sojas,
but na awa Oga God name wi take dey boast.
8Doz nashon go fall skata for groun,
but wi go raiz kon stand gidigba for groun.
9God, make Yu give viktory to awa king
kon ansa awa kry for help.
Currently Selected:
Psalms 20: pcm
Highlight
Share
Compare
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee