YouVersion Logo
Search Icon

Psalms 10

10
Betta Judgement
1My God, wetin make Yu stand far from mi?
Wetin make Yu dey hide wen I dey trobol?
2Wiked pipol dey porshu and ponish poor pipol.
So make di evil trap wey dem set for oda pipol, katch dem.
3Bikos dem dey make mout about di evil tins wey dem dey do.
Yes! Dem dey praiz pipol wey get long-trot and dey curse God.
4Wiked pipol too sturbon and dem dey always tink sey,
“God nor go do mi anytin, bikos E nor kare.”
5Dem dey prosper for evritin wey dem dey do.
Dem nor dey si yor ponishment wey dey wait dem.
Dem dey laf doz wey bi dia enemies.
6Dem dey tell demsef sey, “No bad tin go ever happen to us!
Wi go dey free from trobol forever!”
7Na curse, lie and to treaten pipol, full dia mout.
Na trobol and evil dey dia tongue.
8Dem dey hide wait for di village gate;
where nobody go for si dem kon kill innocent pipol
and dem dey always fine and wound pipol wey nor get help.
9Like lion wey hide for korna,
na so dem dey wait to kill innocent pipol.
Dem dey katch and drag innocent pipol for dia net
like hunta wey katch animal.
10Dem dey kill pipol wey nor get pesin wey go help dem;
doz wey nor get pawa rish dem.
11Wiked pipol dey sey, “God nor dey si us!
E don klose en eye and E nor go even fit si wetin wi dey do!”
12So my God, make Yu raiz-up kon ponish wiked pipol!
Make Yu nor leave doz wey nor get who go help dem!
13Why wiked pipol dey go free sef, even wen dem nor respet God?
Dem dey sey, “God nor go ever ask us sey wetin wi do.”
14But Yu dey si di trobol and wahala wey dem dey kause.
Yu dey si evritin; so make Yu ponish dem.
Doz wey nor get help dey trust Yu
and na Yu dey fight for shidren wey nor get papa and mama.
15Make Yu break wiked and evil pipol hand!
Make Yu ponish dem for dia wiked plans
wey dem tink sey Yu nor know about.
16Na God bi king forever and ever!
Di pipol wey nor dey fear God, go vanish komot from dis world.
17Oga God, na Yu bi di hope wey poor pipol get.
True-true, Yu go hear dia kry kon konfort dem.
18Yu go judge well for shidren wey nor get papa and mama and doz wey dem dey opress,
so dat wiked pipol nor go ever treaten dem again.

Currently Selected:

Psalms 10: pcm

Highlight

Share

Compare

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in