Proverbs 6
6
More Warnin
1My pikin, if yu gri
sey yu go pay di debt wey yor friend owe
2and dem kon owe yu
for di promise wey yu make,
3make yu follow dis my advise,
so dat yu go free yorsef,
bikos yu don fall enter yor neighbour hand bi dat.
Just go honbol yorsef and beg yor neighbour,
so dat e go free yu.
4Make yu do as I tell yu before sleep go katch yu!
Nor rest until yu do am.
5Just try komot yorsef from di trap like bird wey komot from trap
or like deer wey eskape from hunta.
6Lazy pipol, make una learn lesin from di way ant
dey live dia life.
7Dem nor get leader,
govnor or who dey rule dem,
8but dem dey store dia food for dry sizin,
dey wait for wen rainin sizin go start.
9But na how long lazy man go take dey liedan for en bed?
Wen e go ever get up?
10E go sey, “Make I just sleep;
fold my hand and rest small.”
11But as e dey sleep,
evritin wey e get go vanish like sey na tif karry dem go.
12Wetin yuzles and wiked pipol bi like?
Na lie dem just dey lie waka.
13Dem go use dia eyes take make sign
kon use dia legs and fingers take deceive pipol.
14Na bad plans full dia heart
and na so-so trobol dem dey kause.
15Bikos of dis, dem nor go know before wahala go kom meet
and distroy dem finish.
16E get seven tins wey God hate
and E nor wont make anybody do dem and dem bi:
17“Proud pipol;
doz wey dey lie;
doz wey dey kill innocent pipol;
18pipol wey dey always tink bad tins;
pipol wey dey rush to go do wiked tins;
19doz wey dey lie for anoda pesin head
and pipol wey dey kause trobol among dia friends.”
20My pikin, make yu do wetin yor papa tell yu
and nor ever forget wetin yor mama tish yu.
21Always keep and lock dia words for yor heart!
Tie dem round yor neck too.
22Wetin dem tish yu so,
go lead yu wen yu dey waka,
protet yu for nite
kon give yu good advise for day time.
23Wetin dem sey make yu do, bi like lite
and dia korreshon go fit tish yu how to live yor life.
24E go keep yu from bad wimen
and from di sweet-sweet words wey oda men wife dey tok.
25Nor let dia beauti tempt yu
and nor let dia wayo eyes make yu fall.
26Bikos to sleep with ashawo fit make man poor,
but to sleep with anoda man wife go make yu luz yor life.
27Yu fit put fire for yor chest
make e nor burn yu?
28Abi yu fit waka on-top hot shako
make e nor burn yor leg?
29Na so e go bi too,
if yu sleep with anoda man wife
and anybody wey do dat kind tin,
go sofa.
30Pipol fit sorry for pesin wen e tif
bikos e dey hongry
31but if dem katch am,
e must pay back wetin e tif seven times,
even if e nid to sell evritin wey e get.
32But man wey dey sleep with anoda pesin wife,
nor get sense at-all
and e just dey distroy ensef by ensef.
33Pipol go hate, beat and disgrace am
and shame go follow am forever.
34Bikos jealousy dey make husband vex well-well
and e nor dey show mesi wen e won revensh.
35E nor go gri take any money
and no amount of gift go stop en vexnashon.
Currently Selected:
Proverbs 6: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee