Proverbs 5
5
Warnin Against Bad Tins
1My pikin, make yu listin to my wisdom
and put yor ear down for di words wey I dey tish yu.
2Den yu go know how to bihave well and di way yu go dey tok,
go show sey yu get wisdom.
3Anoda man wife lip fit sweet like honey
and en kiss dey smooth like oil,
4but wen evritin don finish,
yu nor go gain anytin inside escept pain and bitterness.
5Di woman go take yu go where dead body dey,
bikos dat road dey lead to deat.
6Di woman nor dey tink about di road wey dey save;
e dey waka lost but e nor know.
7But my pikin, make yu listin to mi
and nor forget wetin I dey tok.
8Run from dat kind woman;
nor even go near en door.
9If yu follow am, nobody go respet yu again
and strenjas go take evritin wey yu get.
10Yes! Strenjas go take all yor propaty
and anoda pesin go kollect evritin wey yu work for.
11Den for di end, yu go kry with pains
kon die go like dat.
12Den yu go sey, “Why I nor follow wetin dem tish mi?
Why I nor let dem korrect mi?
13Why I nor obey my tishas!
Why I nor do wetin dem tok?
14Naw, na wons
dem disgrace mi for publik.”
15Just as yu go take wota from yor own well,
na so too make yu dey faithful and love only yor wife.
16Make yu nor just bi like river
wey anybody fit drink from.
17Make yu keep yorsef for yor wife alone
and know bi for strenjas.
18So always dey happy with yor wife
and find joy for di woman wey yu marry from di biginnin,
19bikos e fine and dey honbol like deer.
Make en smile dey make yu happy
and make en love satisfy yu.
20My pikin, why yu go-go give yor love to anoda woman?
Wetin make yu like di way anoda man wife bi?
21God dey si evritin wey yu dey do
and E know evriwhere wey yu dey go.
22Wiked man sins na trap,
bikos na en own sin net, go katch.
23E go die bikos e nor fit kontrol ensef.
Na en yeye life go send am go en grave.
Currently Selected:
Proverbs 5: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee