YouVersion Logo
Search Icon

Proverbs 17

17
1E betta to chop dry bread with peace of mind,
dan to get plenty food for house with kworel.
2Savant wey dey bihave well go get pawa for di house pass en oga yuzles pikin
and di savant go get share for di oga propaty.
3Na fire dem take dey test gold and silva,
but na God dey test pesin heart.
4Wiked pipol dey listin to bad advise and doz wey dey lie,
dey listin to lie-lie.
5If yu dey laf poor pipol, den yu dey curse God wey kreate dem,
so pesin wey dey happy sey odas fall, God go ponish am.
6Papa and mama dey-dey proud of dia grand-shidren,
bikos na shidren bi dia papa and mama crown.
7Since betta words nor fit kom out from fool mout,
how e go bi for leaders wey dey lie.
8Some pipol tink sey bribe dey work like majik;
dem bilive sey e fit do anytin wey dem wont.
9If yu wont make pipol like yu, den forgive dem if dem do yu bad.
Remember sey bad tin fit skata friendship.
10Pesin wey get sense dey take korreshon
if dem korrect am wons,
but foolish pesin go only take korreshon
afta dem don beat am well-well.
11Deat go kom meet wiked pipol
wey dey always kause trobol.
12E betta make wiked animal attack pesin,
dan to listin to wetin foolish pesin dey tok.
13If yu use bad take pay good,
den bad tin nor go ever komot from yor house.
14To start kworel bi like wen yu leave wota make e dey rush;
so e go good make yu stop am, before e go kause big wahala.
15God nor like pipol wey dey defend wiked pipol
and kondemn doz wey dey innocent.
16Foolish pesin nor get time to spend en money to get wisdom,
bikos e nor undastand wetin wisdom bi.
17Betta friend dey always show en love
and yor relashon go always dey with yu wen yu dey face wahala.
18Na only pesin wey nor get sense
go promise to pay anoda pesin debt.
19Pesin wey like to dey kworel,
like trobol and If yu always dey karry body up,
den yu dey kause wahala for yorsef.
20Make doz wey dey tink and tok bad-bad tins
nor espect any good tin escept trobol.
21Papa and mama wey dia shidren dey do like fool,
na only sadnes and pain dem dey feel.
22Happiness dey give yu good life,
but sadnes dey make pesin die small-small.
23Wiked judge dey take bribe for sekret and bikos of dat,
dem nor go give korrect judgement.
24Pesin wey get sense dey tink and do good tins one-by-one,
but foolish pipol dey start many tins at wons.
25Foolish shidren dey kause pain for dia papa
and dia mama go dey regret.
26E nor good make dem flog innocent pesin
and e dey bad to ponish who dey do good.
27Doz wey dey sure of demsef nor dey tok anyhow
and kwayet pipol dey undastand tins well.
28Pipol go tink sey foolish pesin get sense wen e kwayet and wen e nor tok,
e go bi like pesin wey wise.

Currently Selected:

Proverbs 17: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in