Proverbs 18
18
1Pipol wey nor kare about odas, dey tink only about demsef;
so dem nor go gri take korreshon from oda pipol.
2Foolish pesin nor dey worry weda e undastand sometin or not;
di only tin wey dey en mind, na to show how e wise rish.
3Na sin and shame dey waka togeda.
Wen yu luz yor honor, pipol nor go respet yu again.
4Word wey pesin tok fit give yu sense wey deep like sea
and fresh like river wey dey flow.
5E nor good to favor who do bad,
bikos good pipol nor go get korrect judgement.
6Wen foolish pesin start to argue,
na trobol e dey put ensef.
7Foolish pesin word dey distroy am;
na en own mout dey put am for trobol.
8To do aproko, dey good well-well for mout wen yu dey tok am,
bikos e dey sweet for body.
9Lazy pesin bad like pesin
wey dey distroy tins.
10God name na strong place to hide put,
raitious pipol dey run enter and dem dey-dey save.
11Rish pipol dey tink sey di propaty wey dem get go protet dem
like strong high wall wey dey round di town.
12Respet dey kom before honor;
but distroshon dey wait for proud pipol.
13Make yu dey listin well before yu ansa,
If not, e go bi like sey yu bi stupid pesin wey nor get respet.
14Di mind to live fit enkourage pesin wen e dey sick,
but if e nor get strong mind, e nor get hope bi dat.
15Wise pesin dey always look for knowledge
and en mind dey find wisdom.
16If yu won go meet important pesin,
den karry gift follow body and e go dey eazy for yu to tok to am.
17Di first pesin to tok for kourt dey always dey rite,
until di oda pesin ask am kweshon.
18If men wey get pawa dey tok against each oda for kourt,
to trow dice fit solve di matter.
19To make peace with yor broda wey yu offend,
hard pass to break enter town wey dem guide well-well
and kworel, dey separate friends
like gate wey dem lock with key.
20Wen yu tok betta words, belle go sweet yu,
so make yu let good word kom out from yor mout
and yu go dey happy.
21Wetin yu tok fit save or distroy yor life.
So yu must asept di result of wetin yu tok.
22Man wey find good woman kon marry am,
don si good tin and God go favor and bless am.
23Poor man dey honbol ensef as e dey tok,
but rish pipol dey ansa and tok anyhow.
24Friendship if put yu for trobol,
but some friends go dey klose to yu pass yor own broda.
Currently Selected:
Proverbs 18: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee