Proverbs 16
16
1Even doh wi fit make awa own plans,
na God get di final sey.
2Yu fit tink sey yu dey always do di rite tin,
but na God know wetin dey rite to do.
3If yu tell God make E bless evritin wey yu plan to do,
yu go susid.
4Evritin wey God kreate get en purpose;
but na wahala, wiked pipol go get.
5God hate pipol wey dey karry body up;
E nor go let dem eskape en ponishment.
6If pesin dey honbol and faithful, God go forgi-am en sins.
If yu dey fear God, yu nor go gri do bad tins.
7Wen pesin make belle sweet God,
even en enemies go like bi en friend.
8E betta to dey honest even doh yu nor get plenty money,
dan to use wayo get plenty propaty.
9Pesin fit make en own plan,
but na God dey direct anytin wey e go do.
10Di king dey tok with authority wey God gi-am,
so make e make sure sey e dey judge well.
11Make una nor dey play wayo wen una dey measure and sell tins give pipol,
bikos God nor like am.
12Make kings nor like wiked tins,
bikos na korrect judgement dey make govment strong.
13Kings dey always won hear di trut
and e go favor doz wey dey tok am.
14Wise pesin go try make belle dey always sweet di king,
bikos if di king vex, somebody fit die put.
15Wen di king favor pesin, e dey give life;
e bi like kloud wey dey bring rain for en sizin.
16E betta well-well to get wisdom and undastandin,
dan to get gold and silva.
17Doz wey good nor dey travel pass bad road; so look where yu dey go,
bikos e fit save or distroy yor life.
18Pride dey bring distroshon
and sturbones fit kill pesin.
19E betta make yu dey honbol and poor,
dan to join pipol wey dey karry body up
kon follow dem share di propaty wey dem tif.
20Listin to wetin dem tish yu and yu go dey susesful;
make yu trust God, so dat blessing go follow yu.
21Yu go no pesin wey wise and dey mature bikos of di undastandin wey e get.
As en word sweet rish, na so too e dey give pipol hope.
22Wisdom bi like wota wey dey give life to wise pipol,
but na waste of time to go tish foolish pesin.
23Wise pesin dey tink well before e dey tok;
so wetin e tok dey give pipol hope.
24Good words bi like honey;
e dey sweet di soul kon make body strong.
25Wetin pesin dey do, fit dey good for en eye,
but na deat dey end am.
26Pesin wey wont sometin dey work well for am,
bikos e nid am.
27Wiked pipol dey always look for how to wound odas;
even wetin dem dey tok fit burn and kill pesin like fire.
28Wiked pipol dey do aproko waka;
dem dey kause trobol and break friendship.
29Pipol wey dey kause wahala
dey deceive dia friends enter trobol.
30Make yu dey kareful with doz wey dey look yu with bad eye,
bikos dem don already dey tink bad tin about yu.
31Na long life bi raitious pipol reward
and to get white hair, na betta crown.
32E betta to dey patient dan to bi strong warrior.
E betta make yu kontrol yorsef
dan to kontrol di whole town.
33Wi dey plan as wi wont make tins bi,
but na only God dey choose wetin go happen.
Currently Selected:
Proverbs 16: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee