YouVersion Logo
Search Icon

Proverbs 15

15
1Good ansa dey end vexnashon,
but yeye words dey kause kworel between pipol.
2Wen wise pipol tok, pipol dey undastand well,
but na only yeye words dey kom out from foolish pipol mout.
3God dey wosh evriwhere,
E dey wosh both good and wiked pipol.
4Gentol word na tree wey dey give life,
but lie-lie tongue dey make di spirit weak.
5Na only fool nor dey listin to en mama and papa word;
but anybody wey dey take korreshon, go get sense.
6Pipol wey dey fear God, good tins dey always full dia house,
but wetin wiked pipol get, dey bring trobol.
7Na good advise dey kom out from wise pipol mout;
but foolish pipol heart nor get anytin to give.
8God hate wiked pipol sakrifice,
but E dey enjoy good pipol prayers.
9God nor like evritin wey wiked pipol dey do,
but E love doz wey dey do good.
10Anybody wey nor gri do wetin dey rite, go sofa well-well
and anybody wey nor like korreshon, go die.
11Even Deat and Distroshon nor get sekret for where God dey,
tok-less of human being heart!
12Doz wey dey laf pipol nor dey like korreshon,
so dem dey run from wise pipol.
13Pipol dey smile wen dem dey happy,
but sorrow dey make dia spirit weak.
14Wise pipol dey hongry to learn,
but foolish pipol dey enjoy wetin dem tink sey dem know.
15Pipol wey get heavy heart, get plenty trobol;
but pipol wey dey happy, dey always celebrate.
16E betta to get small propaty and still dey fear God,
dan to get evritin with many-many wahala.
17E betta to chop vegitabol with pipol wey yu love,
dan to chop meat with pipol wey go fit kill yu.
18Pesin wey dey kwik vex, naim dey first kause fight;
but kwayet pesin dey kwayet for evriwhere.
19If yu dey lazy, tins nor go eazy for yu,
but if yu dey do wetin dey rite,
trobol go dey far from yu.
20Shidren wey get sense dey always bring joy to dia papa;
but foolish shidren nor dey respet dia mama.
21Foolishness dey make doz wey nor get sense happy;
but pesin wey get sense,
dey always do di rite tin.
22Plans dey spoil wen good advise nor dey;
but many advise dey bring progress.
23Evribody dey like good ansa,
but e dey good to tok di rite tin for di rite time!
24Wise pipol dey waka for di road wey dey lead to life
and nor bi di one wey go take dem go grave.
25God dey skata proud pipol house,
but wimen wey dia husband don die,
God dey protet dia propaty.
26God hate evil plans,
but E like betta words.
27Long-trot dey kill pesin family finish,
but doz wey hate bribe, go get long life.
28Doz wey dey fear God, dey tink before dem tok;
but na only evil words full wiked pipol mout.
29God dey far from wiked pipol,
but E dey hear raitious pipol prayer.
30Happiness dey bring joy to pesin heart
and good news dey make pesin happy.
31If yu listin well wen pipol dey korrect yu,
yu go dey wise and get sense.
32If yu nor like korreshon, na yorsef yu dey do;
but if yu listin to korreshon, yu go always dey undastand.
33To fear God, dey bring wisdom
and to honbol yorsef, dey bring honor.

Currently Selected:

Proverbs 15: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in