Filippians 4
4
Tins Wey Christians Suppose Do
1My brodas, sistas and friends wey I love, I dey hongry to si una, bikos una dey make mi proud. My friends wey I love, make una stand well inside Christ!
2I dey beg Euodia and Sintike make dem gri togeda inside Christ. 3Yes, my good friends, I still dey tell una, make una help dem. Dem try as dem dey prish di gospel with mi, both Klement and my oda ko-workers, wey dia name dey inside Christ Life Book. 4Make una always dey happy inside Christ. I dey tok again sey, make una dey happy! 5Make evribody know sey una nor like wahala, bikos Jesus go soon kom. 6Make una nor let anytin worry una for mind. Instead, for evry kondishon wey una dey face, make una ask God thru prayer for evritin wey una nid and make una always dey tank am, as una dey pray. 7Den God peace wey pass wetin human being fit undastand, go guide una heart and mind, inside Christ.
8Finally, my brodas and sistas, tins wey bi true; wey get respet; wey fine; wey pipol dey tok good about; wey good well-well; wey rish to praiz, na dis kind tins una suppose to dey tink about. 9So anytin wey una learn, hear and si mi dey do, make una dey do dem too. And di God wey dey give us peace, go dey with una.
Paul Tank Dem
10I dey happy well-well inside Christ, bikos una don finally show sey, una dey tink about how I dey manage. (I know sey una get mi for mind before, but una nor get shance to do anytin for mi). 11I nor dey tok dis one bikos I nid anytin, but na bikos I don learn to dey okay for any kondishon wey I si mysef. 12E get sometaim wey I nor get and sometaim, I dey get plenty. But for evry kondishon, I don learn how to dey okay, weda my belle full or I dey hongry; weda I get plenty or I nor get anytin at-all. 13I fit do evritin thru Christ wey dey give mi pawa. 14But una try well-well as una help mi wen I dey trobol.
15Filippi pipol, una know sey, wen I komot from Masidonia, for di time wen I just start to prish di gospel, na una bi di only church wey help mi and na only una dey follow mi share for my happiness and sofa. 16Bikos even for Tesalonika, una still send tins kom give mi. 17I nor dey tok dis bikos I wont gift, but make una for gain from dis work wey una dey do. 18Naw, I get evritin wey I nid, bikos Epafroditus don give mi di tins wey una send. And na dis bi di ofrins wey dey make belle sweet God. 19My God go give una evritin wey una nid, bikos of en glory and propaty wey dey inside Jesus Christ. 20Make evribody give glory to God awa Papa, forever and ever. Amen.
Last Greetin
21Make una greet God pipol wey dey for Christ. 22God pipol wey dey here dey greet una too, especially doz ones wey kom from Caesar house. 23Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una spirit.
Currently Selected:
Filippians 4: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee