Mark 7
7
Di Farisee Tradishon
1Di Farisee pipol and some law tishas, wey kom from Jerusalem gada for where Jesus dey. 2Dem kon si sey Jesus disciples dey chop bread wen dem neva wosh dia hand. 3(Bikos di Farisee and Jew pipol, nor dey chop unless dem wosh dia hand akordin to dia tradishon. 4And wen dem kom back from market, dem nor dey chop unless dem first wosh dia hand. Dem still dey follow many oda tradishons, like to wosh cup, kettol and chair wey dem dey sidan put chop.)
5Di Farisee pipol and di law tishas kon ask Jesus, “Why yor disciples nor dey do akordin to awa tradishon, but instead dem dey chop with dirty hand?”
6Jesus ansa dem, “Di tin wey Profet Isaya profesai about una, na true, bikos una dey pritend, as dem rite for God word,
“ ‘Dis pipol dey praiz Mi with dia mout,
but dia heart dey far from Mi.
7Dem dey woship Mi for nor-tin,
dey tish sey make pipol obey human being law.
8Dem nor dey respet God law, but dem dey obey human being law.’ ”
9Jesus still tell dem, “Una rijet God kommandment, so dat una go fit keep una own. 10Bikos Moses sey, ‘Make yu respet yor papa and mama’ and ‘Anybody wey curse en papa or mama, dem must kill-am.’ 11But una sey e dey okay for pesin to tell en papa and mama sey, ‘Make yu nor vex, I nor fit help yu, bikos di money wey I suppose give yu, I don gi-am to God.’ 12So, like dis, una nor go let di pesin do good for en mama or papa. 13Na so una dey use una tradishon wey una dey tish pipol take dey spoil God word. And una still dey do many tins like dis.”
14Den Jesus koll di pipol again sey, “Evribody, listin to mi make una for undastand wetin I dey tok. 15Nor bi wetin enter inside pesin body go make am dirty for God eye, instead na wetin kom out from en mout, dey make am dirty. 16Anybody wey get ear, make e hear wetin I dey tok.”
17Wen Jesus leave di pipol enter house, en disciples kon ask am about di parabol. 18E kon tell dem, “Na so una fool rish? Una nor know sey anytin wey from outside enter pesin belle nor go fit make am dirty for God eye? 19Bikos nor bi di pesin heart e dey enter, na en belle and e go shit am komot. (Dis one mean sey all food dey klean.)”
20Jesus kon sey, “Wetin kom out from pesin heart, naim dey make am dirty. 21Bikos to sleep with who yu nor marry, to tif, to kill pesin, 22to sleep with anoda pesin husband or wife, long-trot, evil tins, to deceive pesin, to dey misbihave, jealousy, to spoil anoda pesin, to karry body up and to do foolish tins, na from inside pesin heart all dis bad-bad tins dey from kom. 23All dis evil tins dey kom from inside pesin and na dem dey make pesin dirty for God eye.”
One Woman Faith
24Afta Jesus komot from der, e kon go di aria wey dem dey koll Tyre. Wen e enter one house, e nor wont make anybody know sey e dey der, but e nor fit hide. 25One woman wey evil spirit dey worry en dota kon hear about Jesus and e kom meet am kon fall for en front. 26Di woman na Greek wey kom from Sirofoenicia. E kon beg Jesus make e drive di demon komot from en pikin body.
27But Jesus tell am, “Make di shidren chop beleful first, bikos e nor good to take shidren food give dog.”
28Di woman ansa, “Yes, Oga God, but even dogs dey chop di small-small food wey dey fall from shidren plate.”
29Jesus kon tell am, “Since yor faith strong rish to tok like dis, make yu dey go. Di demon don komot from yor pikin body.”
30Wen di woman rish house, e kon si en pikin sleep for bed and di demon don leave am.
Jesus Heal Deaf And Dumb Pesin
31Den Jesus komot from Tyre kon pass Sidon go Galilee Sea for Dekapolis aria. 32Some pipol karry one man wey nor dey hear or tok kom meet am sey make e tosh di man with en hand.
33Wen Jesus don take di man go korna for where pipol nor dey, e kon put en two fingers inside di man ear, e spit for en hand kon tosh di man tongue. 34Den e look heaven kon sey, “Efratah!” (wey mean, “Make yu open”). 35At wons, di man ear open, en tongue luz and e kon start to tok.
36Jesus kon sey make dem nor tell anybody wetin happen. But dem kon dey tok am for evriwhere. 37Pipol sopraiz well-well dey sey, “Jesus don do evritin well. E even make di pipol wey nor dey hear, hear and pipol wey nor fit tok, e don make dem dey tok.”
Currently Selected:
Mark 7: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee