Mark 6
6
Dem Rijet Jesus For Nazaret
1Jesus kon komot for dat place go en house town with en disciples. 2Wen Sabat Day rish, e kon start to tish for di sinagog.
Many pipol wey hear am sopraiz, dey sey, “Where e for get dis kind sense? Wish kind wisdom God gi-am? And wetin bi all dis mirakle wey e dey do so? 3Nor bi di karpenter, wey Mary born bi dis? Nor bi en brodas bi James, Josef, Judas and Simon? Nor bi en sistas dey with us so?” So dem kon dey vex for am.
4Den Jesus tell dem, “Na only for profet town, among en own pipol and for en own family na-im di profet nor dey get respet.” 5Jesus nor fit do any mirakle for der, so e only tosh some pipol wey nor well kon heal dem. 6Jesus sopraiz, bikos dem nor bilive am. So e komot from der go oda village wey near der kon tish dem.
Jesus Send En Twelf Disciples Go Prish
7Jesus koll di twelf disciples kon send dem two-by-two. E give dem pawa to drive evil spirits komot from pipol body.
8E tell dem make dem only take dia walkin stik for di journey. E sey make dem nor karry bread, bag or money follow body. 9E still sey, “Una fit wear shoe, but make una nor karry estra klot 10and any house wey una enter, make una stay der until una komot for di place. 11If dem nor welkom una or listin to wetin una dey tok for any place, make una shake di san komot from una leg as una dey leave der, to show sey dem rijet di message.”
12So, di disciples go out kon prish sey make evribody turn from sin kom meet God. 13Dem drive many demon komot from pipol body and pour oil for many pipol wey nor well head kon heal dem.
How John Di Baptist Take Die
14King Herod kon hear wetin dey happen, bikos pipol don know Jesus name well-well. Some pipol sey, “John wey dey baptize don wake-up from deat and bikos of dis, e don get pawa to do mirakles.”
15Odas sey, “Na Elijah e bi.”
Some kon sey, “E bi like one profet wey dey before.”
16But wen Herod hear am, e sey, “John wey I sey make dem kut en head komot, don wake-up from deat!”
17Na Herod send men go arrest John put for prison, bikos of Herodias, en broda Filip wife wey e marry. 18Bikos John don tell Herod plenty times sey, “E nor good as yu marry yor broda wife.” 19So Herodias kon get bad belle for John and e won kill-am, but e nor fit. 20Herod dey fear John well-well, so e dey protet am, bikos e know sey John na holy man wey dey do wetin God like. Anytime Herod hear John dey prish, en mind go dey worry am, but e still dey like to listin to am.
21But one day wen Herod dey do en birtday, en ofisas, en sojas oga dem and di leaders for Galilee, dey der with am. 22Wen Herodias dota kom dance, Herod and di pipol wey e invite kon dey happy well-well.
So di king kon tell di girl, “Make yu ask mi for anytin wey yu wont and I go give yu.” 23Herod kon promise sey, “Anytin wey yu as mi, I go give yu, even if e go rish half of my kingdom.”
24So di girl go outside go ask en mama, “Wetin I go ask for?”
Di mama ansa, “Make yu ask for John di Baptist head.”
25Kwik-kwik e rush go meet di king kon tell am wetin e wont, “I wont John di Baptist head for plate naw.”
26Even doh e pain di king well-well, e nor won rijet wetin di girl ask, bikos e don promise for evribody present. 27So di king send di soja wey dey kill criminals, make e go bring John head kom. So di man go inside di prison, go kut John head komot. 28E put di head for plate kon give di girl and di girl go gi-am to en mama. 29Wen John disciples hear wetin happen, dem kom karry en body go beri.
Jesus Feed 5,000 Pipol
30Den di disciples gada round Jesus kon tell am evritin wey dem don do and tish. 31Jesus tell dem, “Make una follow mi make wi go rest for sometaim”, (Bikos many pipol dey-kom-dey-go and time nor dey to chop).
32So only dem kon enter boat go one place where pipol nor dey. 33But many pipol si dem wen dem dey go, so di pipol kon run with leg from all di towns kon first Jesus and en disciples rish di place. 34Wen Jesus kom down from di boat, e si plenty pipol and e kon sorry for dem, bikos dem bi like animal wey nor get who dey look afta dem. So e kon tish dem many tins.
35Wen day don dey dark, en disciples kom meet am sey, “Dis na place wey pipol nor dey stay and day don dey dark. 36Make yu send dis pipol go buy wetin dem go chop for di town and village wey near here.”
37But Jesus ansa, “Make una give dem sometin chop.”
Dem kon sey, “Make wi go take two hundred silva koins buy bread give dem chop?”
38Jesus ask dem, “How many bread una get? Make una go shek.”
Wen dem don shek, dem kon ansa, “Na five bread with two fish.”
39Jesus kon tell di pipol make dem share diasef into group, sidan for grass. 40So dem sidan for difren-difren group, hundred-hundred, fifty-fifty. 41Jesus take di five bread and two fish, e look heaven kon tank God, den e divide di bread. E give en disciples make dem share am for di pipol and e kon divide di two fish among dem too. 42All of dem chop beleful 43and wen dem gada di fish and bread wey remain, twelf basket full. 44Di pipol wey chop di bread, rish 5,000 men.
Jesus Waka On-top Wota
45So Jesus tell en disciples make dem enter boat cross go di oda side for Betsaida, den e send di pipol go house. 46Afta e don tell dem bye-bye, e kon go pray for one mountin.
47Wen evening rish, di boat don rish di sea centre, but Jesus still dey alone for land. 48E si en disciples dey use all dia pawa dey padol di boat, bikos di breeze strong well-well. As morning won rish, Jesus waka kom meet dem, like sey e won pass dem. 49Wen dem si am dey waka on-top di wota, dem tink sey na ghost, so dem kon dey shaut, 50bikos as dem si am, fear katch dem.
But Jesus tell dem, “Make una heart nor shake! Na mi. Make una nor fear.” 51Den Jesus enter di boat with dem, den di breeze kon stop. Dem kon sopraiz well-well, 52bikos dem konfuse and dem nor undastand how Jesus take feed 5,000 pipol.
Jesus Heal Pipol Wey Nor Well
53Afta Jesus and en disciples don cross di river, dem kon rish Gennesaret, den dem tie dia boat for der. 54As dem kom down from di boat, pipol kon si sey na Jesus bi dat. 55Di pipol run pass all di aria, karry di pipol wey nor well for mat go where dem hear sey Jesus dey. 56Anywhere wey Jesus go, weda na village or town or farm, dem go karry di pipol wey nor well for dia market place kon ask Jesus weda dem go fit tosh en klot and evribody wey tosh am, kon well.
Currently Selected:
Mark 6: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee