Bikos to sleep with who yu nor marry, to tif, to kill pesin, to sleep with anoda pesin husband or wife, long-trot, evil tins, to deceive pesin, to dey misbihave, jealousy, to spoil anoda pesin, to karry body up and to do foolish tins, na from inside pesin heart all dis bad-bad tins dey from kom. All dis evil tins dey kom from inside pesin and na dem dey make pesin dirty for God eye.”