YouVersion Logo
Search Icon

Joshua Introdushon

Introdushon
Joshua na di nomba six book for di Bible and e tok about di period from di time wey Moses die go rish wen God take Israel pipol enter di land wey E promise dem and na Joshua bi dia leader. Dem name dis book follow di main pesin wey bi Joshua wey take-ova from Moses. Joshua mean “Na God dey Save.” Di book still show how God take fulfil en promise to Israel pipol wen E give dem Kanaan land as dia own. Di book still diskribe how Israel pipol struggol to keep di kovenant wey dem make with God or obey di God wey bring dem kom di land. E still tok about how Israel pipol take divide di land akordin to di tribes. But since some places still remain, Joshua tell all di tribes sey make dem try take evriwhere for di land. E still make di pipol renew di kovenant wey dem make with di Oga dia God.

Currently Selected:

Joshua Introdushon: pcm

Highlight

Copy

Compare

Share

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in