YouVersion Logo
Search Icon

Deutronomi 34

34
Moses Die
1Den Moses komot from Moab Wildaness kon go Mount Nebo until e rish on-top Pisgah mountin, opposite Jeriko. God show am all di land from Gilead go rish Dan, 2plus Naftali Efraim, Manasseh and all Judah land go rish di sea for far. 3God show am Negev and di valley for Jeriko; di town wey get palm tree and Zoar land. 4Den God tell Moses, “Dis na di land wey I promise Abraham, Isaak and Jakob wen I sey, ‘I go give dis land to yor shidren-shidren.’ I don let yu si am, but yu nor go cross enter.”
5So Moses wey bi God savant kon die for Moab land, just as God bin tok. 6God beri am for Moab land near Bet-Peor, but kon rish today, nobody fit sey, “Na here or na der God beri Moses put.” 7Moses na one hundred and twenty years wen e die, but en eye still klear and e still strong like yong boy. 8Israel pipol mourn for Moses for thirty days inside Moab wildaness; den dem kon stop to mourn for Moses.
Joshua Take-ova
9Naw, Nun pikin, Joshua get wisdom well-well, bikos Moses don pray for am. So Israel pipol dey obey Joshua and dey do God kommand wey E give dem thru Moses.
10E nor ever get any oda profet for Israel wey bi like Moses, wey si God face-to-face. 11God send am go do many signs and wonders for di king for Egypt, en ofisas and for di whole land. 12E nor get any oda profet wey don fit do all di strong and mighty tins wey Moses do for Israel pipol present.

Currently Selected:

Deutronomi 34: pcm

Highlight

Copy

Compare

Share

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in