Joshua 6
6
1Naw, dem lock and dey guide Jeriko gate, so dat Israel pipol don go fit attack am. Dem nor gri make anybody enter inside or go outside.
2God kon tell Joshua, “Si, I won distroy Jeriko for una, plus di king and en sojas. 3Make una sojas mash round di town ones and make una do like dat for six days. 4Make yu tell seven priests make dem karry seven ram horn for di box front, den for di sevent day, make una mash round di town seven times, while di priests go dey blow di trumpet. 5Wen una hear di trumpet sound, make di sojas shaut for war and di town wall go fall rish groun, den una go attack am.”
6So Joshua wey bi Nun pikin kon koll and tell di priests, “Make una karry di Kovenant Box and seven priests must karry seven ram horn for di Kovenant Box front.” 7So e tell di sojas, “Make una waka for front kon mash round di town, while many sojas go dey waka for di Kovenant Box front.”
8Wen Joshua orda en sojas, di seven priests karry di ram horn for God present for front kon bigin blow di horn as God Kovenant Box dey follow dem for back. 9Many sojas dey mash for front of di priests wey dey blow di horn, while di oda guards dey mash follow di box for back dey blow ram horn too. 10Naw, Joshua tell di sojas, “Make una nor shaut or make nois; make una nor tok anytin until di day wey I go tell una sey make una shaut or make nois!” 11So Joshua make sure sey dem karry di Kovenant Box round di town only ones a day. Den dem go back go sleep for dia kamp.
12For early morning di next day, Joshua and di priests karry di Kovenant Box. 13Di seven priests wey karry di seven ram horn for di Kovenant Box front, mash dey blow di horn round di town. Many sojas dey mash for dia front, while di oda guide dey follow for back and dem dey blow dia horn too. 14Dem mash round di town ones for di sekond day, den dem go back to dia kamp. Dem do like dis for six days.
15For di sevent day, dem wake-up for early morning kon mash round di town as before, but dis time, dem mash round am seven times. 16Wen di sevent time rish, di priests kon blow di ram horn and Joshua kon tell di sojas, “Make una shaut for war, bikos God go give dis town to una! 17Di town plus evritin wey dey inside go bi God own, escept Rahab wey bi ashawo and evribody wey dey with am for inside en house, bikos e hide awa pipol wey go spy di town. 18But make una take kare wen una dey keep di tins wey bi God own. If una take any of dem, una go kause wahala for awa kamp and awa pipol. 19All di gold and silva, plus di bronze and all di iron tins, na God get dem. All of dem must go God store house.”
20Wen di sojas hear di ram horn sound, dem kon shaut well-well for war. Di town wall fall rish groun and di sojas run enter di town at wons kon win Jeriko pipol. 21Dem use dia swod take kill evritin wey dey breath for di town, both man and woman, small pikin and old pipol, plus all di animals.
22Joshua kon tell di two men wey kon spy di land before sey, “Make una go di ashawo house den bring en and evribody wey dey di house kom out, just as una promise am.” 23So di men go bring Rahab, en papa, mama, brodas and evribody wey dey en house. Dem bring all en family kom out kon take dem go one place wey dey outside Israel pipol kamp.
24But dem burn di town and evritin wey dey inside, esept di gold, silva, bronze and di iron tins wey dem karry go God store house. 25But Joshua nor kill Rahab wey bi ashawo, en family and evritin wey bilong to am. Rahab kon stay for Israel, bikos e hide di pipol wey Joshua send go spy Jeriko.
26For dat time, Joshua kon swear sey: “Anybody wey sey e won build Jeriko town again, God go kondemn am.
“E first boy pikin go die
as e stay to build am
and en last boy pikin go die
wen e dey put di gate!”
27God dey with Joshua and pipol kon know am for evriwhere.
Currently Selected:
Joshua 6: pcm
Highlight
Copy
Compare
Share
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee