YouVersion Logo
Search Icon

Joshua 20

20
Town Wey Dem Selet
1God kon tell Joshua: 2“Israel pipol don selet di towns wey pesin go for dey save and I tell yu dis tin thru Moses. 3Anybody wey by mistake kill pesin, fit run go der from di man wey go won kill-am.
4“E fit run go one of dis towns kon go di judgement place for di town gate, den judge wetin happen give di leaders for der. Di leaders go take am enter di town kon gi-am where e go stay. 5Wen di pesin wey won take revensh find am kom, dem nor go let am attack di man, bikos na mistake e take kill di pesin. 6E go stay di town until dem go judge en kase for di kounsol or wen di High Priest don die. Den e fit go back to di town wey e from kom.”
7So dem selet Kedesh for Galilee wey dey Naftali kountry on-top di hill; Shekem wey dey Efraim kountry on-top di hill and Kiriat-Arba (wey bi Hebron) wey dey Judah kountry for hill. 8Afta dem cross Jordan River for di east side for Jeriko, dem kon selet Beza for di desert wey bilong to Reuben tribe, Ramot for Gilead wey bilong to Gad tribe and Golan for Bashan wey bilong to Manasseh tribe. 9Dis na di towns wey dem give all Israel pipol and doz wey dey stay with dem. Wen pesin kill anoda pesin by mistake, e fit run go der and who won kill-am nor go fit kill-am again, until di eldas judge en kase.

Currently Selected:

Joshua 20: pcm

Highlight

Copy

Compare

Share

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in