Joshua 19
19
Simeon Share
1Di sekond koin wey Joshua trow na for Simeon tribe and family.
2Dia land na Beersheba, Moladah, 3Hazar-Shual, Balah, Ezem, 4Eltolad, Betul, Hormah, 5Ziklag, Bet-Marcabot, Hazar-Susah, 6Bet-Lebaot and Sharuhen. Dem bi thirteen big and small town.
7Ain, Rimmon, Eta and Ashan. Dem bi four big and small town, 8plus all di towns wey rish Baalat Beer (Rama for Negev).
Dis na di land wey Joshua give Simeon akordin to en family. 9Dem give Simeon land from di ones wey dem give Judah, bikos Judah aria too big for dem.
Zebulun Share
10Di third koin wey Joshua trow na for Zebulun tribe and family.
Di borda for dia aria rish Sarid. 11Di borda from west go Maralah kon tosh Dabbeshet and di valley wey dey near Jokneam. 12From Sarid, e turn face di east for Kislot-Tabor aria kon go Daberat and from der go Jafia. 13From der e cross go east for Gat-Hefa and Et-Kazin aria go rish Rimmon kon turn go Neah. 14E turn from nort go Hannaton till e end for Jeftah-El Valley. 15Dia aria na Kattah, Nahalal, Shimron, Idalah and Betlehem and all of dem na twelf big and small towns.
16All dis na di land wey dem give Zebulun tribe and dia family, plus di big and small towns.
Issakar Share
17Di fourt koin wey Joshua trow na for Issakar tribe and family.
18Dia land na Jezrel, Kesullot, Shunem, 19Hafaraim, Shion, Anaharat, 20Rabbit, Kishon, Ebez, 21Remet, En-Gannim, En-Haddah and Bet-Pazez. 22Dia borda tosh Tabor, Shahazumah and Bet-Shemesh kon end for Jordan River. Dem get sixteen big and small town.
23All dis na di land wey dem give Issakar tribe and dia family, plus di big and small town.
Asher Share
24Di fift koin wey Joshua trow na for Asher tribe and family.
25Dia land na Helkat, Hali, Beten, Akshaf, 26Alammelek, Amad and Mishal. Dia borda tosh Karmel for west and Shihor-Libnat. 27E turn go east kon face Bet-Dagon den tosh Zebulun and Jeftah-El Valley for nort, e still tosh Emek and Neiel Valley kon go Kabul for nort 28till e rish Abdon, Ebron, Rehob, Hammon and Kanah and Greata Sidon. 29E turn face Rama plus di strong-strong towns for Tyre, den e turn face Hosah kon end for di sea near Hebel, Akzib, 30Umah, Afek and Rehob. Dem get twenty-two big and small towns.
31All dis na di land wey dem give Asher tribe and dia family, plus di big and small town.
Naftali Share
32Di sixt koin wey Joshua trow na for Naftali tribe and family.
33Dia borda start from Helef and Zaanannim oak kon go Adami-Nekeb, Jabneel until e rish Lakkum kon end for Jordan River. 34E from der turn face west for Aznot-Tabor till e rish Hukok kon tosh Zebulun for di sout. Asher dey for en west and Jordan River for en east. 35Di strong towns na Ziddim, Zer, Hamat, Rakkat, Kinneret, 36Adamah, Rama, Hazor, 37Kedesh, Edrei, En-Hazor, 38Yiron, Migdal-El, Horem, Bet-Anat and Bet-Shemesh. Dem get nineteen big and small town.
39All dis na di land wey dem give Naftali tribe and dia family, plus di big and small town.
Dan Tribe
40Di sevent koin wey Joshua trow na for Dan tribe and family.
41Dia land na Zorah, Eshtaol, Ir Shemesh, 42Shaalabbin, Aijalon, Itlah, 43Elon, Timnah, Ekron, 44Eltekeh, Gibbeton, Baalat, 45Jehud, Bene-Berak, Gat-Rimmon, 46Jarkon wotaside and Rakkon plus di aria for Joppa front.
47(Dan pipol nor fit win all dia aria, so dem kon go fight and win Leshem. Dem kill evritin for der kon bigin stay der. Dem kon name am, “Dan” wey bi dia grand-grand papa name.)
48All dis na di land wey dem give Dan tribe and dia family, plus di big and small town.
Dem Give Joshua Land
49Wen dem don divide di land into seven, Israel pipol kon give Joshua, Nun pikin some land. 50As God tok, dem kon give Joshua di town wey e ask for, wey bi, Timnat-Serah for Efraim hill kountry. So Joshua build di town kon bigin stay der.
51Eleazar di priest, Joshua wey bi Nun pikin and Israel leaders, na dis bi di whole land wey dem divide and dem rite am for book kon put am for Shiloh for God present. So, dem kon divide di land finish.
Currently Selected:
Joshua 19: pcm
Highlight
Copy
Compare
Share
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee