YouVersion Logo
Search Icon

Isaya 12

12
Tanksgivin Song
1For dat time yu go sey:
“Oga God, I praiz Yu, bikos Yu bin dey vex for mi,
but naw, Yu dey konfort mi
and Yu nor dey vex again.
2Si! Na God dey save mi.
I go trust am and I nor go fear.
Na God dey give mi pawa and strent
and na-im dey save mi.
3As wota dey make pesin wey dey hongry for wota, happy,
na so too I go happy wen God save mi.”
4For dat time, yu go sey:
“Make wi tank God! Make wi praiz en name!
Make wi tell evribody about di tins wey E do!
Make wi tell dem how God big and strong rish.
5Make wi sing give God,
bikos of di great tins wey E don do
and make di whole world hear di news.
6Make evribody wey dey for Zion shaut and sing!
Bikos Israel God dey holy and great
and E dey stay with wi wey bi en pipol.”

Currently Selected:

Isaya 12: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in