1
Isaya 12:2
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Si! Na God dey save mi. I go trust am and I nor go fear. Na God dey give mi pawa and strent and na-im dey save mi.
Compare
Explore Isaya 12:2
2
Isaya 12:3
As wota dey make pesin wey dey hongry for wota, happy, na so too I go happy wen God save mi.”
Explore Isaya 12:3
3
Isaya 12:5
Make wi sing give God, bikos of di great tins wey E don do and make di whole world hear di news.
Explore Isaya 12:5
4
Isaya 12:4
For dat time, yu go sey: “Make wi tank God! Make wi praiz en name! Make wi tell evribody about di tins wey E do! Make wi tell dem how God big and strong rish.
Explore Isaya 12:4
5
Isaya 12:1
For dat time yu go sey: “Oga God, I praiz Yu, bikos Yu bin dey vex for mi, but naw, Yu dey konfort mi and Yu nor dey vex again.
Explore Isaya 12:1
6
Isaya 12:6
Make evribody wey dey for Zion shaut and sing! Bikos Israel God dey holy and great and E dey stay with wi wey bi en pipol.”
Explore Isaya 12:6
Home
Bible
Plans
Videos