Hibru 6
6
Warnin For Christians
1E don rish wen wi go stop to learn only di first tins wey Christ tell us, so make wi dey grow kon know Christ more-more. Wi nor nid to still dey tish una about tins wey dey kause deat; why wi must bilive God; 2wetin baptizim mean; to put hand for pipol head; to wake pipol from deat and about God final judgement. 3As God dey help us, na new-new tins wi go dey tish una about di faith. 4Wen pesin don first know di trut; taste God gift from heaven; know di Holy Spirit; 5don taste God good work and di betta wey dey kom, 6den e kon start to sin, dat pesin nor go fit turn from sin kom meet God, since e don kill God Pikin for di sekond time and disgrace am for publik. 7Wen rain don soak groun and e bear betta fruits for di farmer, dat mean sey God don bless di man. 8But if na so-so shuku-shuku and grass di groun dey bear, dat mean sey e dey yuzles. So God go curse and distroy am with fire. 9But as for una wey bi my friends, even doh wi dey tok to una like dis, wi know sey dis tins nor go happen to una, bikos una don undastand God salvashon. 10God nor dey support pipol anyhow. E go remember how una help en pipol before-before and how una still dey help dem naw. Una bi God pipol and E nor go forget di love wey una show en shidren. 11As una still dey dis world, wi wont make una kontinue to love one anoda, so dat wetin una dey hope for, go kom. 12So make any of una nor taya, but make una dey patient and bilive, so dat una go gain God promise.
13Nobody big pass God, bikos God swear with en name wen E promise Abraham sey, 14“Na mi bi Oga God, I go bless yu well-well and yor shidren go plenty.” 15Bikos Abraham get patient, God kon gi-am wetin E promise am. 16Wen pipol won setol matter, dem dey swear with pesin wey big pass dem and di agriment wey dem make, dey end di matter. 17So wen God won show en pipol sey E nor go break en promise, E kon swear with ensef. 18God nor dey lie! So di promise wey E make and ensef wey E take swear, na two tins wey nor go shange. Since wi don run go meet God make E guide us, e good make awa mind strong, so dat wi nor go fear as wi bilive en promise. 19Dis hope strong for awa heart like ship wey dem tie make e nor for move, bikos di hope wey wi get dey kamkpe and strong gidigba. Di promise go take us pass di curtain for heaven, until wi rish where God dey; 20di place where Jesus don enter for us and don bikom High Priest forever, just as Melkizedek bi.
Currently Selected:
Hibru 6: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee