1
Hibru 6:19
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Dis hope strong for awa heart like ship wey dem tie make e nor for move, bikos di hope wey wi get dey kamkpe and strong gidigba. Di promise go take us pass di curtain for heaven, until wi rish where God dey
Compare
Explore Hibru 6:19
2
Hibru 6:10
God nor dey support pipol anyhow. E go remember how una help en pipol before-before and how una still dey help dem naw. Una bi God pipol and E nor go forget di love wey una show en shidren.
Explore Hibru 6:10
3
Hibru 6:18
God nor dey lie! So di promise wey E make and ensef wey E take swear, na two tins wey nor go shange. Since wi don run go meet God make E guide us, e good make awa mind strong, so dat wi nor go fear as wi bilive en promise.
Explore Hibru 6:18
4
Hibru 6:1
E don rish wen wi go stop to learn only di first tins wey Christ tell us, so make wi dey grow kon know Christ more-more. Wi nor nid to still dey tish una about tins wey dey kause deat; why wi must bilive God
Explore Hibru 6:1
Home
Bible
Plans
Videos