Hibru 5
5
God High Priest
1Na God dey choose High Priest wey go ripresent pipol for en present. Di priest dey offa both gift and sakrifice for dia sins. 2Di High Priest fit sorry for doz wey sin, bikos dem nor know wetin dem suppose know, since en ensef dey sin too. 3Bikos of dis, e dey offa sakrifice for en sin and di pipol own. 4Nobody dey fit bi High Priest with en pawa bikos e wont make pipol honor am, but na only doz wey God koll to bi priest, just as E koll Aaron. 5Christ nor praiz ensef wen e bikom High Priest, but na God praiz am wen E sey, “Yu bi my Pikin! Today, I don bikom yor Papa.” 6God still sey, “Yu bi priest forever as Melkizedek bi.” 7Wen Jesus still dey dis eart, e pray and kry to God wey go save am from deat. God hear en prayers, bikos e obey God for evritin. 8Even doh e bi God Pikin, na thru all di tins wey e sofa, e take learn how to obey. 9Wen God don make Christ pafet finish, e kon save evribody wey obey am. 10God make Christ to bi High Priest like Melkizedek.
Stay Inside Faith
11Wi get many tins to tok about, but dem nor eazy to esplain, bikos una nor dey gri obey. 12E don tey wen una bi Christian, so by naw, una suppose to dey tish odas. Instead, una still wont make pesin kom tish una di first tin wey dey God word. Una still dey drink milk, instead of una to dey chop solid food. 13Anybody wey still dey drink milk, bi like small pikin wey nor know good from bad. 14But solid food na for mature pipol and dem get betta sense to know wetin dey good and bad.
Currently Selected:
Hibru 5: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee