Hibru 4
4
God Promise Us Rest
1Even doh God promise us rest, e good make wi dey kareful, so dat some among us nor go miss di promise. 2Bikos dem prish God word give us, just as dem prish am give dem too. But dem nor take am sirious, bikos wen dem hear am, dem nor gri bilive am. 3Na only wi wey bilive go fit enter di place where God rest dey, bikos God sey, “I vex kon swear for dem, so ‘Dem nor go ever enter my place where rest dey!’ ” 4Wi know sey God ready and dey wait, bikos Bible sey, “Afta God don kreate evritin finish, E kon rest for di sevent day.” 5E still sey, “Dem nor go ever enter my place where rest dey!” 6God promise sey wi go enter di place where en rest dey, yet doz wey first hear di message, nor enter, bikos dem disobey am. 7But God don plan anoda time wen wi go enter en rest and dat time, “Na today”, bikos E don tok am for en word before thru David. 8Bikos if to sey Joshua give dem rest, God for nor tok about anoda day. 9So, di really “Sabat Day” rest, still dey kom for God pipol. 10Bikos pesin wey enter God rest, don rest from all en work, just as God rest from en own work too. 11So make wi try well-well, so dat wi go enter dat place where rest dey and non of us go fall like di odas wey nor obey. 12God word dey alive, e get pawa and e sharp pass knife wey get two sharp side. Di word dey divide pesin soul from en spirit and e dey divide bone from bone; bikos God know wetin wi dey tink for awa mind. 13Nor-tin wey God kreate fit hide from am and evritin dey naked to God, bikos wi go must tell am how wi live awa life.
Na Jesus Bi Di High Priest
14Jesus wey bi God Pikin, na-im bi awa High Priest wey don go heaven. Make wi hold am tait and always dey bilive am. 15Dis awa High Priest undastand us wen wi dey weak, bikos all dis temptashon wey wi dey face so, e face dem too, but e nor sin. 16Make wi nor fear to enter where God throne dey: di place where grace dey, so dat wi go get mesi and God grace go help us wen wi nid help.
Currently Selected:
Hibru 4: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee