YouVersion Logo
Search Icon

Galatians 3

3
Law Or Faith
1Galatia pipol, una nor get sense at-all! Who turn una to fool naw? Bikos na for una front wi for show sey Jesus Christ die for cross! 2Na di tin wey I won know from una, bi dis: Una receive di Spirit, bikos una dey do wetin di law tok or na bikos una bilive wetin wi prish give una? 3Na so una mumu rish? True-true, una start with di Holy Spirit, but naw, una won finish di work with human being pawa. 4Una sofa dis many tins for nor-tin? True-true, una really sofa for nor-tin. 5Wetin make God give una di Spirit to do mirakle? Na bikos una do wetin di law tok or bikos una bilive wetin una hear?
6Just as Abraham bilive God and God koll am raitious man, 7na so too, doz wey bilive, go bi Abraham shidren. 8Dem rite for God word before sey, “E go asept Gentile pipol, wen dem get faith” and na dis make am tell Abraham before di time rish sey, “E go bless evribody, bikos of am.” 9So pipol wey bilive, God go bless dem togeda with Abraham, bikos dem bilive. 10Pipol wey dey under di law and dem nor dey do evritin wey di law tok, dey under curse, bikos dem rite am sey, “E nor go betta for anybody wey nor dey do evritin wey dey di law.” 11Dis one show sey, nobody dey good for God eye, bikos e dey obey di law. So anybody wey dey raitious, must live by faith. 12Di law nor dey bring faith, but di pesin wey dey do wetin di law tok, go live by wetin e dey do. 13Christ don save us from di curse wey di law bring, bikos e die for cross for us (just as dem rite am, “Anybody wey dem hang for tree, curse dey en head”), 14so thru Christ, Abraham blessings go kom meet Gentile pipol and wi go receive di Spirit wey God promise us, thru faith.
Na Promise, Nor Bi Law
15My brodas and sistas, make I use wetin dey happen evriday for life take make ezample for una: Wen pipol don make agriment, nobody go fit trow di agriment for korna or add anytin join am. 16Wi know sey God make dis promise with Abraham and en pikin. God word nor sey, “to di shidren”, but e sey, “and to yor pikin,” and e mean only one and dat one, na Christ. 17Na wetin I dey tok bi dis: Di law wey kom afta four hundred and thirty years, nor get pawa to break di agriment and promise wey God and Abraham don make before. 18Bikos if promise dey kom thru di law, den e nor bi promise again. But wi know sey, na thru promise, God take bless Abraham.
19Na awa sin make law dey and na so e go bi, until di pikin wey God promise, go kom and na thru angels, God take give us di law thru en profet. 20Wi know sey pesin wey bi middo-man dey stand between two pipol, but na only one God dey. 21So di law dey against God promise? No! Bikos if di law dey give pesin life, den raitiousness go must kom thru di law. 22But God word kondemn evritin and evribody under sin, so dat wi; di pipol wey bilive, go get God promise thru Jesus Christ.
Na God Shidren Get Di Promise
23Before faith kom, wi dey under di law, bikos di law whole us like prisonas. 24So na di law bi awa tisha before Christ kom, so dat wi go fit tok sey wi dey raitious thru faith. 25But since faith don kom, wi nor dey under any tisha again. 26Bikos thru Jesus Christ, all of us don bikom God shidren by faith. 27Una wey dem don baptize inside Christ, don wear Christ for body like klot. 28E nor matter weda una bi Jew or Greek pipol, savant or free pesin, man or woman, bikos all of una dey inside one body for Christ. 29And if e bi sey una bilong to Christ, den una bi Abraham shidren and pipol wey go inherit wetin God promise.

Currently Selected:

Galatians 3: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in