YouVersion Logo
Search Icon

Galatians 2

2
Di Apostles Support Paul
1Afta fourteen years, I kon go back to Jerusalem with Banabas and Titus. 2I go der bikos of di revelashon wey I receive, den I tell dem about wetin I dey prish give Gentile pipol. But I tok with di oga dem, so dat dem go dey sure sey, I dey prish Christ message. 3Titus dey with mi; even doh en na Greek pesin, dem nor sey e must sekonsaiz. 4Dem diskuss dis matter, bikos of di fake brodas with dia wayo wey dem take dey spy di freedom wey Christ give us, so dat dem go fit make us dia slave. 5But wi nor give dem shance, so dat di trut wey dey di gospel, go last for una.
6But doz wey tink sey dem bi oga, (wetin dem bi, nor mean anytin to mi; bikos God nor dey support bad tin); dem wey bi leaders for di church nor add anytin to my message. 7But dem kon si sey na God sey make I prish en word to pipol wey dem nor sekonsaiz, just as E sey make Pita prish to doz wey dem sekonsaiz, 8(Bikos na thru God pawa Pita take prish to Jew pipol and na di same pawa I take dey prish give Gentile pipol too), 9so wen James, Pita and John wey bi leaders for di church, si sey God give mi grace, dem kon dey support mi and Banabas sey, “Make wi dey prish give Gentile pipol and doz wey dem sekonsaiz.” 10But dem sey make wi always remember poor pipol and na wetin dey my mind to do, bi dat.
Paul Shalenge Pita
11But wen Pita kom Antiok, I kon shalenge am, bikos wetin e do, nor good. 12Pita dey chop with Gentile pipol until some pipol wey James send, kom rish der. As Pita si dem, e kon stop to chop with Gentile pipol, bikos e dey fear di pipol wey kom, since dem bilive sey evribody must sekonsaiz. 13Oda Jew pipol kon dey pritend like Pita, sotey Banabas join dem too. 14But wen I si sey dem nor dey do wetin dem rite for God word, I kon tell Pita for dia front, “If yu wey bi Jew, dey do like Gentile pipol, how yu wont take make Gentile pipol live like Jew pipol?”
Who Bi Jew Or Gentile Sef
15Wi bi Jew pipol bikos of how dem born us and wi nor bi Gentile pipol wey bi sinnas. 16Wi know sey nobody dey free from God judgement, bikos na so di law tok and pipol go only dey free, if dem get faith for Christ. Since wi don bilive Christ, wi suppose to dey do good thru di faith wey wi get for Christ and nor bi to dey do wetin di law tok and wi nor go dey free from judgement, wen wi do only wetin di law tok. 17Make wi dey kommit sin as wi dey try to do good, bikos wi get faith for Christ? If na so, dat mean sey Christ don dey support sin! 18Naw, if I dey ripair di law wey I don first skata, dat mean sey I dey break God law. 19As for di law, I don die to am, so dat I go fit dey alive with God. 20I don die with Christ for cross, so nor bi mi dey live again, but na Christ dey live inside mi. Di life wey I dey live naw, na bikos of di good tins wey God pikin do inside mi, bikos e love and die for mi. 21I nor go trowey God grace; bikos if na wetin di law tok go make pesin good, den Christ die for nor-tin!

Currently Selected:

Galatians 2: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in