YouVersion Logo
Search Icon

Galatians 1

1
I Salot
1Na mi Paul, rite dis leta, (nor bi human being make mi apostle, but na Jesus Christ and God awa Papa wey raiz am from deat). 2Mi and di brodas wey dey here, dey greet una wey dey Galatia. 3Make God awa Papa and Oga God Jesus Christ grace and peace, dey with una. 4Na Jesus die for awa sins, bikos na so God awa Papa wont am. 5Make all glory bi en own forever and ever! Amen.
One Gospel
6I sopraiz sey una kwik turn back from di Pesin wey koll una with en grace kon bigin follow oda tishing. 7Nor bi sey anoda gospel really dey, but some pipol dey disturb una, bikos dem won shange wetin wi prish about Christ. 8But if wi (or angels wey kom from heaven) tish una difren tins from di one wey wi prish give una before, make God distroy us with fire! 9As I tok before, I dey repeat am again, if anybody dey tish difren tins from di ones wey wi prish give una before, make God trow dat pesin for hell! 10Una tink sey, I dey try to do tins make pipol for like mi? Abi I dey do wetin God wont? Or I dey try to make belle sweet pipol? If I dey try to make belle sweet pipol, den I nor bi Christ savant again!
Paul Na Apostle
11My brodas and sistas, I wont make una know sey di gospel wey I dey prish, nor bi human being give mi. 12Bikos I nor get or learn am from anybody, but I get am thru di revelashon wey Christ give mi.
13Una don hear about di kind life wey I dey live before as Jew pesin; how I trobol di church kon dey try to distroy am. 14I grow among Jew pipol kon know di relijon pass many of my mates for my kountry and I know my grand-grand papa dem tradishons. 15But God koll mi with en grace kon separate mi even before dem born mi. 16E show mi en pikin, so dat I go fit prish about am give Gentile pipol. I nor go meet anybody make e advise mi 17and I nor go Jerusalem go meet pipol wey bi apostle before mi, but I komot der go Arabia, den I kon go back to Damaskus.
18Afta three years, I go visit Pita for Jerusalem, so dat e go tell mi wetin I go do and I stay with am for fifteen days. 19But I nor go si any oda apostle apart from James, wey bi Jesus Christ broda. 20God dey si wetin I dey rite, bikos evritin wey I dey rite to una so, na true! 21Afta dis, I kon go Siria and Silisia aria. 22But di pipol for di church wey dey Judea, nor know mi. 23Dem only dey hear sey, “Di pesin wey dey trobol us before, don dey prish di message wey e bin dey try to distroy.” 24So dem kon dey praiz God bikos of mi.

Currently Selected:

Galatians 1: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in