Deutronomi 30
30
Turn Kom Meet God
1I don give una choice to choose between di blessing and di curse. Wen all dis tins don happen to una and una dey stay for di nashons where di Oga una God skata una go, una go remember di choice wey I give una. 2If una and una shidren-shidren turn kom meet God kon obey all en kommand wey I dey give una today, with una heart and soul, 3den di Oga una God go sorry for una. E go bring una kom back from di kountries wey E bin skata una go kon make una prosper again. 4Even if una skata for evriwhere for di eart, di Oga una God go gada and bring una kom back to una land. 5Di Oga una God go take una enter di land wey E give una grand-grand papa, so dat e go bi una own too. E go make una prosper and many pass una grand-grand papa dem. 6Di Oga una God go sekonsaiz una and una shidren heart by ensef, so dat una go love am with all una heart and soul, den una go get betta life. 7But di Oga una God go put all dis curse for una enemies head and doz wey dey won kill una. 8Den una go obey God vois kon keep all en kommand wey I dey kommand una today. 9For all di work wey una go do with una hand, God go make una prosper. Una and una animals go get plenty pikin and una plant go produce plenty food. Bikos God go dey happy to make una prosper, just as E dey happy wen una grand-grand papa dey prosper. 10Dis tin go happen wen una obey di Oga una God vois kon keep all en law and kommand wey dem rite for di Law Book, bikos una don turn kom meet God with all una heart and soul.
Life And Deat
11Di way wey I dey kommand una today, nor dey too strong for una and e nor too mush. 12E nor dey for heaven so make nobody sey, “Who go-go heaven go bring di kommand kom for us, so dat wi go hear and do am?” 13Di kommand nor dey for di oda side for di river, so una nor nid to ask, “Na who go cross di river go bring am for us, so dat wi go hear and obey am?” 14But di word and kommand dey here with una. Una know am and una fit read am, so make una obey am.
15Make una know sey, “I dey give una choice between good and bad; life and deat. 16If una obey di Oga una God kommand wey I dey give una today so, den una kon love di Oga una God; dey do as E tok; dey keep en rules, law and kommand, una go get long life kon dey many more-more and di Oga una God go bless una for di land wey una won enter as una own.
17“But if una turn against God and E kommand kon dey woship juju and oda gods, 18I dey tell una today sey una go die! Una nor go stay tey for di land wey una dey cross Jordan River go take as una own.
19“I koll heaven and eart make dem bi witness against una today sey, I don give una choice between life and deat, blessing and curse. So make una choose life, so dat una with una shidren go get long life. 20Den una go love di Oga wey bi una God kon dey obey en vois and hold am strong, bikos God go give una long life for di land wey E promise to give una grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob.”
Currently Selected:
Deutronomi 30: pcm
Highlight
Copy
Compare
Share
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee