“I koll heaven and eart make dem bi witness against una today sey, I don give una choice between life and deat, blessing and curse. So make una choose life, so dat una with una shidren go get long life. Den una go love di Oga wey bi una God kon dey obey en vois and hold am strong, bikos God go give una long life for di land wey E promise to give una grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob.”