Deutronomi 29
29
God Kovenant
1Dis na di kovenant wey God kommand Moses sey make e make with Israel pipol wen dem dey Moab, plus di kovenant wey E make with dem for Mount Sinai.
Dem Travel
2Moses gada evribody for Israel kon tell dem, “Una don use una own eye take si evritin wey God do to Fero, all en savant and di whole Egypt. 3Una eye don si en great judgement, signs and wonders. 4But till today, God neva make una undastand all dis tins or give una eyes wey fit si or ear wey dey hear! 5I karry una thru di wildaness for forty years, but una klot or sandal nor tear. 6Una nor chop bread or drink wine or any oda drink, but E give una food, so dat una go know sey na-im bi di Oga una God.
7“Wen wi rish here, King Sihon for Heshbon and King Og for Bashan kom fight us, but wi win dem. 8Wi take dia land kon gi-am to Reuben, Gad and half of Manasseh tribes as dia own.
9“So make una obey di words wey dey dis kovenant, so dat e go betta for una for evritin wey una dey do. 10Today, all of una stand before di Oga una God, di head for di tribes, una eldas, una ofisas, evry man for Israel, 11una small pikin, wifes and di strenjas wey dey stay with una, plus doz wey dey kut wood or karry wota, 12so dat una go asept di kovenant wey di Oga una God dey make with una today. 13Today, God go sey una bi en pipol and na-im bi una God, bikos na-im promise una and una grand-grand papa Abraham, Isaak, Jakob. 14Nor bi only una I dey make dis kovenant with, 15but na with all di pipol wey stand with una for di Oga awa God present today, even with doz wey nor dey with us today.
Disobey
16“(Una know how wi dey live awa life wen wi dey Egypt and how wi take cross many nashons as wi dey travel. 17Una si di bad tins and di juju wey dem make with wood, stone, silva and gold.) 18Make no man, woman, tribe or family among una leave di Oga una God kon go woship gods for oda kountries. Make nobody among una get any tree wey go bear fruit wey bitter or fit kill.
19“Make una make sure sey nobody among una wey dey hear dis tins today, bilive sey evritin dey okay with am, even doh e nor dey hear pipol word. Dis kind tin go skata all of una, weda una dey good or bad. 20God nor dey ready to forgive dat pesin. Instead, God vexnashon and jealousy go raiz for di pesin and all di curse wey dey dis book go bi en own. 21God go pick and judge only di pesin from all di tribes for Israel akordin to all di curse wey dey dis Law Book.
22“En shidren-shidren wey go kom afta una, plus di strenjas wey go kom from far place, all of dem go si di wahala for dat land and di sickness wey God go send for dia head. 23Fire and sulfur go kover di whole land. Dem nor go fit plant for der and nor-tin go grow for der. E go bi like Sodom and Gomorrah, Admah and Zeboiim, di towns wey God vex distroy. 24Den all di nashons go ask, ‘Wetin make God do all dis tins for dis land? Wetin make God dey vex like dis?’
25“Den di pipol go sey, ‘Na bikos dem nor gri obey di kovenant wey God wey bi dia grand-grand papa God make with dem wen E bring dem kom out from Egypt. 26Dem kon go serve and woship oda gods wey dem nor even know and God sey make dem nor woship doz gods. 27Na dis tin make God dey vex for dem well-well for dis land and naim make am ponish dem with all di curse wey dey dis book. 28So God don vex remove dem from dia land kon karry dem go anoda land and evribody dey si as e bi today.’ ”
29Na di Oga awa God get all di sekret tins, but di tins wey E tell us, na for wi and awa shidren-shidren forever, so dat wi go fit obey all di words for dis law.
Currently Selected:
Deutronomi 29: pcm
Highlight
Copy
Compare
Share
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee