YouVersion Logo
Search Icon

Deutronomi 24

24
To Marry Again
1Wen man marry woman and e nor like am, bikos e don si one bad karata for en body, e fit rite divorce paper give di woman, den tell am make e komot from en house. 2Wen di woman komot di house, e fit marry anoda man. 3But if di sekond husband still get problem with di same woman kon divorce am or di man die, 4di first husband nor go marry am again, bikos di woman nor dey klean and dis tin nor dey good for God eye. Make una nor bring problem kom di land wey di Oga una God dey give una.
5Make una nor put man wey just marry among di sojas or gi-am any oda work. E must dey free to spend one year for en house, so dat di wife go dey happy.
6Wen una borrow pesin money, make una nor take en grindin stone as shorti, bikos dat na di only tin wey di family take dey chop.
7If una katch pesin wey kidnap anoda Israel pesin kon dey trit am like slave or sell am, di pesin wey kidnap anoda pesin, must die. Like dis, una go remove bad-bad tins from among una.
Respet Human Being
8As una dey do as di priest sey make una do, make una dey kareful about bad diziz. Make una obey all di kommand wey I don give una. 9Make una remember wetin di Oga una God do to Miriam as una dey kom out from Egypt.
10If una borrow anytin give una neighbour, make una nor enter en house kon take wetin e use as shorti. 11Una go wait for outside den e go enter en house go bring am for una. 12If una neighbour na poor man and e kon give una en klot as shorti for di money wey e borrow, make una nor keep dat klot till di next day. 13Make una take di klot go give who get am wen evening rish, so dat en body go dey warm for nite and e go bless una, den di Oga una God go si una as pipol wey dey do good.
14Make una nor opress poor pipol and doz wey dey work for una; weda dem bi Israel pipol or strenjas wey dey stay with una. 15Una must pay dem for dia work evriday wen evening rish, bikos dem poor and dey wait dat money. If una nor pay dem, dem fit kry give God and di sin go dey una head.
16Make una nor kill papa or mama, bikos of di sin wey dia shidren kommit, or kill shidren bikos of wetin dia papa and mama do; if una go kill pesin at-all, e must bi for en own sin.
17Una must judge well for di strenjas wey dey with una; doz wey nor get papa and mama and woman wey en husband don die. Make una nor ever take dia klot as shorti for debt. 18Make una always remember sey una bi slave for Egypt, before di Oga una God kon save una. Na dis make mi give una dis kommand.
19Wen una harvest una plant kon leave some for di farm, make una nor go back go gada dem. Make una leave doz ones for strenjas; doz wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die, den di Oga una God go bless una for all di work wey una dey do. 20Wen una dey plok olive fruit from en tree, di ones wey remain bilong to doz wey bi strenjas; wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die. 21Wen una dey gada grape for una vineyard, make una nor go back again go gada wetin remain; bikos doz ones na for doz wey bi strenjas; wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die. 22Make una remember sey una bi slave for Egypt before and na dis make mi dey kommand una to do all dis tins.

Currently Selected:

Deutronomi 24: pcm

Highlight

Copy

Compare

Share

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in