Deutronomi 25
25
1If two pipol kworel kon go kourt and di judge sey one dey rite and di oda one dey wrong. 2If di judge sey make dem flog di one wey dey wrong, di judge go kommand am make e liedan for en front make dem flog am. 3But make una nor flog pesin pass forty times, bikos if una flog am pass forty times, den una don disgrace am bi dat.
4Make una nor stop una melu make e nor chop wen e dey harvest for una.
Respet Odas
5If two brodas dey stay togeda and one die and e nor get boy pikin, di wife wey en husband don die must nor marry anoda man wey nor dey dat family. Instead, di woman husband broda go marry am kon kare for am. 6Den di first boy wey di woman go born, go ansa dat one wey don die name, so dat dem nor go forget di broda name for Israel.
7But if di broda sey e nor go fit marry en dead broda wife, den make di woman go ripot to di eldas for di town gate sey, “My husband broda sey e nor fit keep en broda name for Israel; so e nor gri marry mi!” 8Den di eldas for di town go koll and tok to am. If e still sey, “I nor won marry am,” 9den di woman go waka go meet am for di eldas front kon remove en sandal from e leg den spit for en face. Den di woman go sey, “Make dis kind tin happen to any man wey nor gri keep en broda name for Israel!” 10Den dem go dey koll en family, “Family wey dem pul di man sandal komot en leg.”
11If two men dey fight with hand and one wife kon join help en husband attack di oda, den di woman use en hand take hold di oda man private part, 12una go kut di woman hand komot and make una nor sorry for am.
13Wen una dey measure tins, una must measure well 14and make una get only one kontaina for una house to take measure. 15Make una always dey use di rite skale take measure, so dat una go get long life for di land wey di Oga una God dey give una. 16Doz wey dey measure with fake skale, dey sin against di Oga una God.
Amalek Pipol
17Make una nor ever forget wetin Amalek pipol do una wen una just dey kom out from Egypt. 18Dat time, as una taya and dey hongry, bikos dem nor dey fear God, dem attack una kon kill doz wey dey stagga dey kom for back. 19So wen di Oga una God don give una rest from all una enemies for di land wey E promise una, una must distroy Amalek pipol finish for dis world and nor of dem go remain.
Currently Selected:
Deutronomi 25: pcm
Highlight
Copy
Compare
Share
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee