Kolossians 4
4
Masta And Savant
1Una wey bi masta, make una trit una savants well and nor shit dem, bikos una know sey, unasef get masta for heaven.
Prayer For Paul Mission
2Make una dey sirious for una prayer. Make una dey shine una eye as una dey tank God wen una dey pray. 3Like dis too, make una dey pray for us, so dat God go give us betta shance to tok about Christ sekret, wey make mi dey prison. 4Make una pray make I tok well, so dat pipol go undastand mi. 5Make una dey wise as una dey tok with pipol wey nor dey follow Christ. Make una use evry shance wey una get well. 6Make all of una word dey good and sweet like wetin dem put sugar, so dat una go know how to ansa evribody.
Last Greetin And Kommand
7Tikikus, my broda wey I love and awa Oga God savant; wey dey work well-well like mi, go tell una evritin wey dey happen to mi. 8Na bikos of dis I send am kom meet una, so dat una go know how tins bi for us and make e for give una heart. 9Onesimus, di broda wey dey with us, wey wi love well-well, wey bi one of una, I dey send am follow Tikikus. Dem go tell una evritin wey dey happen for here.
10Aristakus, wey follow mi dey prison dey greet una and Mark wey bi Banabas kousin (wey wi bin tell una sey, if e kom meet una, make una welkom am) dey greet una too. 11Jesus wey dem still dey koll Justus, dey greet una. Jew pipol wey bi Christian and dey follow mi do God work, na only dem dey help mi. 12Epafras, wey bi one among una and Christ savant, dey greet una. E dey pray well-well for una, so dat una leg go strong for groun and una go grow as una dey learn di tins wey God wont. 13Bikos I bi witness sey, e don work well-well for una and doz wey dey Laodicea and Hierapolis. 14Awa friend Demas and Luke, wey wi love well-well, wey bi doctor, dey greet una too. 15Make una tell di brodas and sistas wey dey Laodicea, with Nimfa and di pipol wey dey gada for en house sey, I greet dem.
16And afta una don read dis leta, make una let di pipol for di church wey dey Laodicea, read am too. Den make una still read di leta wey I rite give dem.
17Make una tell Arkippus sey, make e finish di work wey Christ gi-am.
18Mi Paul, dey rite dis greetin with my own hand. Make una remember di shains wey dem take tie mi and make God grace dey with una.
Currently Selected:
Kolossians 4: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee