YouVersion Logo
Search Icon

2 Tesalonians 2

2
Judgement Day
1Naw my brodas and sistas, for di time wen Jesus go kom and wen God go gada us go meet am, wi won tell una sey, 2make fear nor dey una mind or spirit; even doh wi tell or rite give una sey Christ go soon kom. 3Make nobody deceive una. Bikos dat day nor go kom until trobol go first kom and true-true, di pesin wey God go distroy, go kom out. 4E go oppoz and karry ensef pass God and oda tins wey pipol dey woship. E go even sidan for God Temple dey tok sey e bi God.
5Una remember sey wen I dey with una before, I tell una all dis tins. 6And una know wetin dey stop am, bikos e go only kom out wen en time don rish. 7Dis wikedness don already dey work for sekret and dem go dey sekret until di pesin, wey bi di Holy Spirit wey dey whole dem, go komot for road. 8Den evribody go know who dis wiked man bi and God go distroy am with breeze from Christ mout kon beri am with di glory wey dey kom. 9Di wiked man go kom with Satan pawa and e go do difren mirakles and wonders. 10E go use wayo deceive doz wey go perish, bikos dem nor won love and respet di trut wey for save dem. 11So God go make dem deceive dis pipol well-well and dem go bilive dia lie-lie. 12Den God go distroy dem, bikos dem enjoy sin instead of di trut.
Stand Well For Groun
13But my brodas and sistas wey God love, wi dey always tank God for una evritime, bikos God don choose una from di biginnin sey, E go save una with di Holy Spirit pawa wey go make una dey holy, since una get faith and trut. 14E koll una enter en salvashon thru awa message, so dat una go fit get share for Christ glory. 15So, my brodas and sistas, make una stand well for groun kon whole wetin wi tish una tait; weda na thru di words wey wi tok or letas wey wi rite.
16Naw I dey pray sey, God wey love and give us betta konfort thru en grace and hope, 17go enkourage and give una pawa for all di good work wey una dey do or di words wey una dey tok.

Currently Selected:

2 Tesalonians 2: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

Video for 2 Tesalonians 2