2 Tesalonians 3
3
Make Una Pray For Us
1Finally, my brodas and sistas, make una pray for us, so dat Christ message go kontinue to spread kon get glory just as e really get among una. 2Make God diliver us from wiked and evil pipol, bikos nor bi evribody get faith. 3But Christ dey keep en promise and E go make una strong. 4Wi get mind sey Christ go help una and una go do all di tins wey wi tell una. 5I pray make God guide una heart to undastand en love more-more, so dat una go get Christ patient.
Make Una Live Well
6My brodas and sistas, wi dey kommand una with awa Oga God Jesus Christ name sey, make una nor follow bilivers wey dey do anyhow and nor dey do as wi tell dem. 7Una know sey una suppose to dey imitate us, bikos wi nor bihave anyhow wen wi dey with una. 8Wi nor chop anybody food wey wi nor pay for. Instead, wi dey struggol and work hard for day and nite, so dat wi nor go bi wahala to una. 9Nor bi sey wi nor get rite to ask una, but wi won use awasef as ezample for una, 10bikos even wen wi dey with una, wi tell una sey, “Pesin wey nor ready to work, make e nor chop.”
11Wi hear sey some pipol among una dey leave anyhow and dem nor dey mind dia business, instead dem dey put eye for anoda pesin tin. 12Wi dey kommand and enkourage dis kind pipol with awa Oga God Jesus Christ name sey, make dem do dia work well, so dat dem go fit feed demsef. 13My brodas and sistas, make e nor taya una to do good.
14But if anybody nor obey awa message thru dis leta, make una look dat kind pesin well-well and make nobody follow am waka or do anytin togeda, so dat shame go katch am. 15Make una nor si am as enemy, but make una korrect am as una broda.
Last Word
16Naw, make Christ wey dey give peace, give una en peace evritime and make di peace dey with una always.
17Na mi Paul dey rite and greet una with my own hand, just as I dey do for evry leta wey I don send kom meet una. 18Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with all of una.
Currently Selected:
2 Tesalonians 3: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee