2 Samuel 13
13
Amnon And Tamar
1King David pikin Absalom get one fine sista wey en name na Tamar. David get anoda pikin wey bi Amnon wey love Tamar well-well.
2E love am well-well sotey e kon dey sick, bikos e nor dey possibol for am to sleep with Tamar. And bikos di girl na virgin, dem nor let am near any man.
3Amnon get one wayo friend and en name na Jonadab and na David broda, Shimei born am. 4Jonadab ask Amnon, “Wetin make di king pikin dey vex evry morning? Naw, make yu tell mi wetin dey happen?”
Amnon ansa, “I love Tamar wey bi my half broda Absalom, sista.”
5Jonadab tell am, “Make yu do like sey yu nor well kon go liedan for bed. If yor papa kom si yu, den yu go tell am sey, ‘Abeg, make yu tell Tamar my sista sey make e kom give mi food. I wont make e make di food for here where I go dey si am, den serve mi by ensef.’ ”
6So Amnon do like sey e nor well kon go liedan for bed. Wen David go si am, e kon tell di king sey, “Abeg! Make yu tell Tamar make e kom bake kake for here make I dey si am, den serve mi by ensef.”
7So David send message go meet Tamar for di palis sey, “Make yu go Amnon house go make food for am.” 8Wen di girl go der, e si Amnon sleep for en bed, so e take flower kon bake kake for en front. 9E remove di kake from di pan kon go give Amnon make e chop, but e nor gri chop, instead e sey, “Make evribody go outside,” den all of dem kon komot. 10Den Amnon tell Tamar, “Bring di kake kom give mi for bed, den serve mi by yorsef.” So di girl karry di kake go where e dey. 11As Tamar dey feed am, at wons Amnon drag am kon sey, “Make yu kom sleep with mi!”
12Tamar ansa, “No! Make yu nor force mi do dat kind bad tin wey dey bring disgrace! 13How I go take face pipol for publik again? Dem go disgrace yu for Israel too. So abeg, make yu go tell di king, I dey sure sey e go give mi to yu as yor wife.” 14Amnon nor gri, but bikos e get pawa pass di girl, e kon force and sleep with am.
15Afta Amnon don sleep with Tamar, e kon hate am pass di wey e love am before. Den e tell am, “Make yu get out komot here!”
16Tamar kon ansa, “No! For yu to send mi go like dis, na dat crime big pass di one wey yu don kommit so!”
But Amnon nor gri listin to am. 17E koll en savant kon tell am, “Make yu porshu dis woman komot from where I dey! Go trow am outside, den lock my door!” 18Di savant push Tamar go outside kon lock di door. Tamar wear one long gown wey kover evriwhere and wimen wey neva marry dat time, na dem dey wear am. 19Den Tamar put shako for en head, tear en gown kon use en hand kover en face as e dey kry dey go.
20Wen Absalom en broda si am, e kon ask, “My sista! Na true sey Amnon dey with yu since? Abeg, make yu nor let dat one vex yu too mush. Na yor half broda e bi, so nor tell anybody about am.” So Tamar stay for Absalom house kon dey vex.
21Wen David hear wetin happen, e vex well-well. 22But Absalom nor tell Amnon anytin, weda na good or bad, but e kon hate Amnon bikos of wetin e do to en sista Tamar.
Absalom Revensh
23Afta two years don pass, wen Absalom won kut hair komot from en sheep body for Baal-Hazor, wey dey near Efraim town, e kon invite all di king sons kom der. 24E go meet David kon tell am, “My king, I won kut my sheep hair. Yu fit kom di party with yor ofisas?”
25Di king ansa, “No my pikin, if wi kom, di wahala go too mush for yu.” Absalom still dey beg make di king kom, but e nor gri, instead e sey make Absalom dey go.
26Absalom tell am, “Yu fit let Amnon, my broda kom?” Di king ansa, “Why yu wont make e kom?” 27But Absalom kontinue to beg, till David kon gri make Amnon with en oda brodas go.
Absalom prepare betta party for kings 28kon tell en savants, “Make una look, wen Amnon don drink well-well, den if I give di orda, make una kill-am. Make una nor fear, but get mind, bikos I go take all di blame!” 29So en savants do wetin Absalom tok kon kill Amnon. David shidren wey remain kon klimb dia horse bigin run.
30As dem dey road dey go house, news kon rish David sey, “Absalom don kill all en shidren and no one remain.” 31Di king stand up, tear en klot kon use en body nak groun. All en savants wey dey der with am, still tear dia klot too.
32But Jonadab wey bi David broda, Shimei pikin kon sey, “My king, dem neva kill all yor shidren, na only Amnon dem kill. Yu suppose know sey Absalom go kill-am, since di time wen e force and sleep with en sista Tamar. 33So make yu nor bilive di news sey all yor shidren don die, na only Amnon dem kill.”
34As dis tin happen, Absalom kon run.
Dat time, one soja dey kom from work and e si many pipol dey kom from di hill for di road wey dem dey pass kom from Horonaim. So e go meet di king kon tell am wetin e si.
35Jonadab tell David, “Just as I tell yu, na yor shidren dem dey kom so.”
36As e just tok finish, David shidren kon enter inside. Dem bigin kry and David with all en ofisas kry well-well too.
37Absalom run go meet Geshur king kon stay der with Talmai wey bi Ammihud pikin. But na evriday David for en son.
38Afta Absalom run, e stay Geshur for three years. 39But wen di king don forget about Amnon deat, e kon dey hongry to si Absalom again.
Currently Selected:
2 Samuel 13: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: