YouVersion Logo
Search Icon

2 Samuel 14

14
Absalom Kom Back
1Joab know sey David won si Absalom, 2so e send for one wise woman for Tekoa. Wen di woman kom, Joab tell am, “Make yu do like sey yu dey mourn; wear mourning klot kon skata yor hair. Make yu bihave like woman wey don dey mourn since. 3Den go meet di king kon tell am wetin I tell yu,” So, Joab tell am wetin e go tok.
4Di woman wey kom from Tekoa town, go meet di king, bow kon sey, “My king! Make yu help mi!”
5Di king ask am, “Wetin yu wont?”
Di woman ansa, “Oga! I bi poor widow wey en husband don die. 6I born two boys and dem kon dey kworel for farm and bikos nobody dey to hold dem, won kon kill di oda one. 7And naw, my rilashons sey make I give dem my pikin wey remain, so dat dem go kill-am, bikos e kill en broda. If dem do like dis, I nor go get pikin again. Dem go distroy my last hope and nobody go dey again to ansa my husband name.”
8So di king ansa, “Make yu dey go yor house and I go take kare of dis matter.”
9Di woman wey kom from Tekoa kon sey, “My king! Anytin wey happen, make dem blame mi, bikos yu and yor royal family dey innocent.”
10Di king ansa, “If anybody make yu fear, make yu bring am kom meet mi and e nor go disturb yu again.”
11Di woman sey, “My king, abeg make yu pray give yor God, so dat my rilashons nor go kommit di crime wey big pass di first one kon go kill my oda pikin.”
David ansa, “I use God name take promise sey nobody go tosh yor pikin.”
12Di woman still sey, “I beg yu, my king! Make I tok anoda tin,” David ansa, “Okay.”
13Di woman tell am, “Why yu do dat kind tin to God pipol? Yu neva let yor own pikin kom back from where e hide put since, so yu don kondemn yorsef with wetin yu just tok so. 14One day, all of us go must die, bikos wi bi like wota wey pour for groun wey dem nor fit gada again. But God nor dey kill pesin, instead E go tink of how E go take bring di pesin kom back to ensef.
15“Naw! My king, di tin wey make mi kom tok to yu bi sey di pipol dey treaten mi, so I tell mysef sey I go tok to yu and yu go do wetin I ask. 16I know sey yu go listin to mi kon save mi from di pesin wey dey try to kill mi and my pikin, so dat dem go remove us from di land wey God give en pipol.
17“Oga, I tok to mysef sey yor promise go make mi dey save, bikos di king bi like God angel wey know good from bad. Make God wey bi yor God dey with yu!”
18Di king ansa, “I won ask yu one kweshon and yu must tell mi di whole trut.”
Di woman ansa, “My king, make yu ask.”
19Di king ask, “Nor bi Joab send yu kom?
“Di woman ansa, My king, I use evritin wey dey holy take swear sey, e nor get how I go take dodge yor kweshon. Na Joab wey bi yor offisa tell mi wetin I go do and wetin I go tok. 20But e do am to take solve dis problem. My king get sense like angel and e know evritin wey dey happen.”
21So di king koll and tell Joab, “I don gri to do wetin yu wont. So make yu go look for Absalom kon bring am kom back.”
22Joab bow for David kon sey, “My king, make God bless yu! Naw, I know sey yu dey happy with mi, bikos yu gri with wetin I tok.”
23Den e go Geshur go bring Absalom kom Jerusalem. 24But di king give orda sey make Absalom nor stay for di palis. Di king sey, “I nor won si am.” So Absalom go stay for en own house and e nor kom where di king dey.
Absalom And David
25E nor get pesin wey fine rish Absalom for Israel. From en head go rish leg, evriwhere dey okay. 26En hair tick and heavy well-well sotey na wons e dey kut am a year wen e don too long. En hair heavy rish five pounds if dem use palis standard take measure am.
27Absalom born three boys and one girl wey dem dey koll Tamar and e fine well-well.
28Absalom stay two years for Jerusalem and e nor si di king. 29Den Absalom send message go koll Joab make e go meet di king for am, but Joab nor gri kom. Absalom send for am again and e nor gri kom. 30So Absalom tell en savant, “Si, Joab farm near my own and e plant barley put. Make una go burn am.” So dem kon go burn di field.
31Joab go Absalom house kon tell am, “Wetin make yor savants burn my farm?”
32Absalom ansa, “Bikos yu nor gri kom wen I sey make yu kom. I wont make yu go meet di king kon ask am: ‘Wetin make mi komot from Geshur kom stay here? E for betta for mi pass dis place wey I dey so.’ ” Absalom still sey, “I wont make yu arrange for mi make I si di king and if I dey guilty, make dem kill mi.”
33So, Joab go meet David kon tell am wetin Absalom tok. Di king send message go koll Absalom kom and wen e kom, e bow for di king front, den di king welkom am with kiss.

Currently Selected:

2 Samuel 14: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in