2 Samuel 12
12
Natan Message
1God send Profet Natan go tell David, “E get two men wey dey stay for di same town; one get money and di oda one poor. 2Di rish man get many melu and sheep 3and di poor man get only one sheep wey e buy. E dey kare for am and di sheep grow for en house with en shidren. E dey gi-am wetin e dey chop; di sheep dey drink wota with di man cup kon sidan for di man leg. Di sheep bi like pikin to am.
4“But one day, di rish man get visitor for en house. E nor won kill en own animal take kook for di visitor, instead e go take di poor man sheep take kook for dem.”
5David vex for di rish man well-well kon sey, “I swear with God name, di man wey do dis tin, must die! 6E must pay four times for di wiked tin wey e do.”
7So Natan tell David, “Na yu bi di man and dis na wetin di Oga wey bi Israel pipol God tok. I make yu king for Israel and I save yu from Saul. 8I give yu en wifes and kingdom; I make yu king for Judah and Israel. If dem nor rish for yu, I for still give yu many oda tins. 9Wetin kon make yu disobey my kommand? Why yu do dis wiked tin? Yu kill Uriaya for war; yu allow Ammon sojas kill-am, den yu kon take en wife! 10Naw, for evry generashon, yor shidren-shidren go die anyhow, bikos yu nor obey mi kon take Uriaya wife.
11“I swear sey I go make somebody for yor family bring trobol kom give yu. Yu go si am wen I go kollect yor wife from yu kon gi-am to anoda man and e go sleep with dem for publik. 12Yu sin for sekret, but I go make dis tin happen for publik make all Israel pipol si am.”
13So David sey, “I don sin against God.”
Natan ansa, “God don forgive yu, so yu nor go die. 14But bikos yu show God sey yu dey sorry for wetin yu do, yor pikin go die.” Den Natan kon go en house.
David Pikin Die
15God kon make di pikin wey Uriaya wife born for David sick well-well. 16David pray to God make di pikin well. E nor gri chop anytin and evry nite, e go enter en room liedan for groun. 17En ofisas for house go meet am make e for stand up, but e nor gri or chop anytin with dem.
18Afta one week, di pikin kon die and fear nor let David ofisas tell am di news. Dem sey, “Wen di pikin dey life, David nor dey ansa us wen wi tok to am, na how wi go take tell am sey di pikin don die? E fit go wound ensef o-o!”
19Wen David si sey dem dey tok to diasef, e kon feel sey di pikin don die. So e ask dem, “Di pikin don die?”
Dem ansa, “Yes! E don die.”
20So David stand up go baf; e komb en hair kon shange en klot. Den e go woship for God house. Wen e rish di palis, e ask for food and e chop am as dem just bring am.
21En ofisas tell am, “Wi nor undastand dis tin! Wen di pikin dey live, yu kry for am and yu nor gri chop, but as e just die, yu get up go chop!”
22David ansa, “Yes! I kry and fast wen e still dey live. I tink sey God go forgive mi, so dat di pikin nor go die. 23But naw wen e don die, why I go dey fast? I go-go where e dey one day, but e nor fit kom meet mi for here again.”
Dem Born Solomon
24Den David konfort Batsheba en wife. E sleep with am again and e born boy and David koll am Solomon. God love di pikin 25and E kommand Profet Natan make e koll am Jedidaya, bikos God love am.
David Win Rabbah
26Joab still kontinue en fight against Rabbah wey bi di kapital town for Ammon and e don dey win am. 27E send messenjas go meet David sey: “I don attack Rabbah and I don take-ova where en wota dey kom from. 28Naw, make yu gada yor oda sojas kon attack di towns, den take am by yorsef. I nor wont make anybody praiz mi sey na mi win am.”
29So David gada en sojas go attack Rabbah and e win am. 30David take gold crown from Ammon pipol juju wey bi “God Milkom” and di gold heavy rish seventy-five pound and jewel dey inside am too. David take am kon wear am for en own head. E still karry many tins from di town. 31David use di town pipol take work well-well with saw, iron hoes and axe, den e force dem make bricks. Na so e do give di pipol wey dey di oda towns for Ammon. Den en and en men kon go back to Jerusalem.
Currently Selected:
2 Samuel 12: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: