1 Timoti 6
6
Savant Work
1Una wey bi savants, make una dey respet una masta, so dat nobody go tok bad about God and wetin wi dey tish. 2Make una nor disobey una masta, bikos dem bi bilivers. But make una serve and love dem well, bikos di mastas wey una dey serve, na Christian dem bi.
Lie-lie Tishings
Timoti, make yu tish dis tins and dey enkourage evribody to obey am. 3If anybody dey tish wetin nor korrect and nor gri with awa Oga God Jesus Christ tishing and as God wont make wi dey live awa life, 4dat pesin dey proud and na only to dey argue and kworel, e know. Dis kind tin nor good, bikos jealousy; kworel; lie-lie; to dey suspet odas anyhow 5and wahala, naim e dey kause. Dia mind don spoil and dem nor know di trut again, bikos dem tink sey dem fit use God work take make money.
6To live as God wont and dey happy with wetin E give yu, dey bring betta reward. 7Bikos wi nor bring anytin kom dis world and true-true, wi nor go take one singol tin komot from dis world afta wi don die. 8But if wi get food to chop and klot to wear, make dem rish us. 9Pipol wey won get money by force, dey fall enter temptashon and dem dey get troat for yeye tins wey go distroy and put dem for wahala. 10Pesin wey love money, go get wahala, wiked and evil tins. Bikos some pipol one get money by force, dem don fall komot from di faith kon wound demsef anyhow.
11But yu wey dey serve God, make yu nor put hand for all dat kind tin. Instead, make yu dey struggol to do wetin dey rite and good; dey keep yor promise; dey love; get patient and dey gentol. 12Make yu fight di fight wey dey make faith strong and whole di life wey nor dey end, wey go make pipol praiz God, bikos na dis make am koll yu. 13Before God wey dey give life to all tins and Jesus Christ wey tok well for Pontius Pilate front, I dey tell yu from my heart sey, 14make yu obey dia kommand without fault or blame, until awa Oga God Jesus Christ go kom. 15Bikos wen di time don rish, Christ go kom from heaven with God mighty pawa: Na God bi di King for all kings and Oga God of all oga. 16Dis God nor fit die and E dey stay for lite wey nobody fit waka near. Lite wey human being neva fit si. Make all honor and pawa bi en own forever and ever. Amen!
17Make yu give dis kommand to rish pipol. Tell dem sey, make dem nor dey karry body up kon dey trust dia money wey nor get value and make dem dey trust God wey dey give us evritin wey wi nid to take enjoy dis life. 18Tell dem sey, make dem use dia money take do good. Make dem dey do plenty good works kon dey give doz wey nor get and make dem always dey ready to share with odas. 19If dem dey do like dis, dem go dey use dia money and propaty take lay good foundashon for dia future, so dat dem go get life wey nor dey end.
20Timoti, make yu guide wetin God give yu well-well. Nor put yor mout for yeye tins or matter wey pipol wey nor know God dey tok and do, bikos dem dey oppoz yu with wetin dem feel sey dem know. 21Some pipol don fall komot from di faith, bikos dem dey listin to pipol wey dey do doz bad tins.
Make God grace dey with all of una.
Currently Selected:
1 Timoti 6: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee