1 Korintians 11
11
How To Woship God
1Make una follow mi as I dey follow Christ.
2I dey praiz una, bikos una always dey do di tins wey I tell una, 3but I wont make una undastand sey as Christ bi evribody head, na so too husband bi head for en house and na God bi Christ head. 4So any man wey dey pray or prish God message kon kover en head dey woship God, dey disgrace Christ. 5And any woman wey dey pray or prish God message and e nor kover en head, dey disgrace en head, wey bi en husband; e for betta sey di woman shave en head. 6If di woman nor one kover en hair, den make e go shave am. 7Man nor nid to kover en head, bikos e dey show as God glory bi. But woman dey show as man glory bi; 8bikos God nor kreate di man from woman, but E kreate di woman from man. 9God nor kreate man bikos of woman, but E kreate woman, bikos of man. 10Bikos of di angels, di woman must kover en head to show sey na en husband dey protet am. 11As wi dey serve Christ, di woman and di man, dey togeda for Christ body. 12Aldo God make woman from man, but na woman dey born evribody, even doh na God kreate evribody. 13Make una judge by unasef weda e dey good for woman to dey prish God word wen e nor kover en head. 14Wetin make pipol for di world dey sey, na disgrace for man to karry long hair? 15But long hair dey make woman fine well-well. God give di woman di long hair, so dat di hair go kover di woman head. 16Dis na how dem dey do tins for God church, so nobody go fit follow mi kworel for wetin I dey tok.
17Di way una dey woship God, dey kause wahala pass di good wey E dey do for una. Bikos of dis, I nor go fit praiz una. 18Bikos I hear sey wen una gada dey woship God for church, na so-so kworel una dey kworel and I bilive sey some for wetin I hear, na true. 19Bikos if una nor kworel, wi nor go know di good ones among una. 20Wen una dey togeda, nor bi di Oga God Supper una dey chop? 21But before evribody go rish di meetin, some pipol among una don start to chop and drink, wen odas dey hongry. 22Una nor get house wey una go for chop and drink? Abi una hate God church? Una won disgrace pipol wey nor get anytin to chop? Wetin I go fit tell una naw? I nor go fit praiz una at-all.
23I don already tell una wetin awa Oga God Jesus do for di nite wen dem sell am. And na Christ tok am by ensef. E take some bread for en hand 24and afta e don tank God, e divide am kon sey, “Dis na my body wey I dey give una. Make una always dey chop am to remember mi.” 25Afta dem chop finish, Jesus take di cup kon sey, “Dis na my blood wey God take make new kovenant with una. Make una always dey drink am to remember mi.” 26Jesus mean sey, wen una chop di bread kon drink from di cup, una dey tell odas about Christ deat until e go kom back.
27Bikos of dis, anybody wey chop di bread or drink di wine anyhow wey e like, dat pesin don sin against Christ body and en blood. 28So make evribody shek ensef, before e chop di bread and drink from di cup. 29But if una nor undastand sey na una bi Christ body, una don already kondemn unasef with di way wey una dey chop and drink from di cup. 30Na dis make many of una wey nor well, weak and some among una don even die. 31But if wi judge awasef, God nor go ponish us. 32But wen God judge and ponish us, E dey do am, so dat E nor go kondemn us with dis world. 33My brodas and sistas, make una dey wait for evribody, before una go start to chop di Oga God Supper. 34But if anybody really dey hongry, make e chop kom from en house. Den wen una dey togeda, una nor go kondemn unasef. So wen I kom, I go tell una oda tins wey una suppose know.
Currently Selected:
1 Korintians 11: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: