YouVersion Logo
Search Icon

1 Korintians 12

12
Spiritual Gifts
1My friends, una bin ask mi about spiritual gifts. 2I won make una remember sey, before una bigin follow Christ; na juju una dey serve. 3Naw, I wont make una know sey, anybody wey God Spirit dey lead, go sey, Jesus naim bi Oga God and e nor go ever curse am.
4Na many spiritual gifts God dey give pipol, but all of dem na from di same Spirit. 5And wi get difren ways to serve God 6and each of us dey do difren tins. But na di same God dey work for awa life and E dey help us do evritin. 7Each of us get difren gift wey di Spirit give us and wi dey use am do good. 8Some among us dey fit speak with wisdom and odas with knowledge, but na di same Spirit dey give us all dis gifts. 9To oda pipol, di Spirit dey give dem faith or di pawa to heal sick pipol. 10Di Spirit dey give odas di pawa to do mirakle and e make some pipol profets and some dey fit know wen God Spirit dey among us. Odas dey tok with difren-difren language and some among us go tell una wetin di tins wey dem dey tok, mean. 11But na di same Spirit dey do all dis tins and e dey choose di kind gift wey e wont give each pesin.
Difren Membas For One Body
12Christ body get difren part like evry oda body. 13Some pipol among us na Jew and odas na Gentile. Some na slave and odas dey free. But God Spirit baptize us kon make us part for Jesus Christ body. Naw, all of us dey drink from dat same Spirit. 14Nor bi only one part awa body get, but dem many. 15If di leg for awa body sey, “I nor bi hand, so I nor bi part for di body.” Nor bi di body di leg still dey? 16And if di ear sey, “I nor bi eye, so I nor bi part for di body.” Nor bi di body di ear still dey? 17If to sey di whole body na eye, wi nor for fit hear anytin and if to sey all di body na ear, wi nor for fit smell anytin. 18But God don put evry part for awa body, just as E wont am. 19If na only one part dey di body, den di body nor go bi as e suppose bi again. 20But as e bi so, na many parts dey make one body. 21So, di eye nor go fit tell di hand sey, “I nor nid yu” and di head nor go fit tell di leg sey, “I nor nid yu too.” 22So, wi nor go fit do anytin with awa body without di part wey wi feel sey, e dey weak. 23Di part wey wi tink sey dey important, wi dey trit dem with respet and di part wey nor really dey outside, wi dey trit dem well. 24But awa body nor nid all dis treatment. Bikos na God make awa body, so di part wey wi fit sey nor dey important, dey important well-well. 25God do am like dis, so dat all di parts for di body go dey work togeda and each part go dey kare for oda part. 26If one part dey sofa, di oda parts dey sofa too. But if dem praiz one part, di oda parts go dey happy.
27All of una dey Christ body. And each of una, na part for di body. 28So for di church, God first choose apostles, before profets and tishas. E still choose some wey dey do mirakle, odas wey dey heal sick pipol, some wey bi leaders and odas wey dey tok with difren-difren language. 29Nor bi evribody bi apostle. Nor bi evribody bi tisha. Nor bi evribody fit do mirakle. 30Nor bi evribody fit heal sick pipol. Nor bi evribody fit tok wetin dis language mean. 31But I wont make una ask for di gift wey betta pass, so dat I go show una di way wey betta pass all dis tins.

Currently Selected:

1 Korintians 12: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in