YouVersion Logo
Search Icon

1 Korintians 10

10
Nor Serve Juju
1My brodas, I wont make una remember wetin happen to awa papa dem wey follow Moses. God kloud protet dem as dem dey waka pass di Red Sea. 2Na der dem for baptize dem wen dem dey follow Moses wey bi God savant. 3All of dem chop and drink di same spiritual 4bread and milk. Dem drink from di spiritual Rock wey follow dem go and dat Rock, na Jesus Christ. 5But den, God nor dey happy with some among dem, so many of dem kon die for inside wildaness. 6Naw, all dis na ezample for us, so dat wi nor go do bad tins as dem do, 7or woship juju like some among dem. Just as God word sey, “Di pipol sidan to chop and drink, den dem kon start to play.” 8Make wi nor follow ashawo life like some among dem, wey make 23,000 pipol die for one day. 9So make wi nor tempt Christ as some among dem dey do before snake kon distroy dem. 10Make una nor komplain like di way some for dem do before distroshon angel kon distroy dem. 11Dem rite dis tins wey happen to dem to tish us lesin and na ezample for doz wey go dey wen di world go end. 12So pesin wey tink sey e stand, make e take kare, if not, e go fall. 13E nor get anytin wey dey happen to una naw, wey neva happen to odas before, but God dey keep en promise and E nor go allow una pass thru wetin una nor go fit bear.
14So my brodas, make una run from bad tins. 15I dey tok to pipol wey get sense. Make una tink about wetin I dey tok. 16Wen wi drink from di Oga God Supper cup, dat mean sey wi dey share from Christ blood. Wen wi chop from di bread wey wi divide, dat mean sey wi dey share for Christ body. 17Bikos wi dey chop from one bread, all of us don bi one body, even doh wi many. 18Israel pipol dey chop juju food, but dem still dey share for Christ altar. 19I nor dey sey juju food or di one wey dem sakrifice mean anytin. 20But wetin I mean bi sey, wetin bad pipol dey sakrifice, na for demon, nor bi for God. 21Yu nor fit drink from God cup and demon cup for di same time. 22Abi wi dey try to make Christ vex? Wi strong pass God?
23Pipol sey, wi fit do evritin. Dat na true, but nor bi evritin dey good. Wi fit do evritin, but nor bi evritin dey good for di body. 24Make pesin nor dey tink for ensef alone, but for oda pipol too. 25Make una mind dey okay as una dey chop any meat wey dem dey sell for market. 26Bikos God word sey, “Di eart and evritin wey dey inside, na di Oga God own.” 27If pesin wey nor know God invite yu kom chop for en house, make yu chop wetin e give yu, nor ask kweshon, bikos of wetin dey yor mind. 28But if di pesin tell yu sey, “Dem sakrifice dis food give juju,” make yu nor chop am bikos of di pesin wey tell yu and en konscience. 29I nor mean yor konscience, but di oda pesin own. So bikos of wetin anoda pesin dey tink, I nor go fit do wetin I wont do? 30If I tank God for my food, wetin go make anybody fight mi bikos of di food wey I tank God for? 31But anytin wey una dey do, weda una dey chop or drink, make una do am to honor God. 32Live yor life so dat yu nor go kause trobol for Jew or Greek pipol or for pipol wey dey God church. 33Make una dey do as I dey do; bikos I dey always try to please evribody instead of mysef, bikos I wont make God save dem.

Currently Selected:

1 Korintians 10: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in